States affected by powerful storm wey dey sweep across US for middle of Thanksgiving holiday
- Author, Ana Faguy
- Author, James FitzGerald
- Author, Sareen Habeshian
- Published
- Read am in 4 mins
Hundreds of thousands of homes for US no get light afta one severe weather hit hit di kontri during di Thanksgiving holiday.
One powerful storm wey bring high winds, heavy rain and coastal flooding lash on Thursday.
Pennsylvania na di state wey power cuts affect pass, according to monitoring site Poweroutage.us.
Conditions now dey expected to improve, although forecasters warn say e fit take some time.
Di West Coast also dey affected by dia own storms.
Flight disruption also continue, as dem delay plenty flights and cancel hundreds on Friday - wey bin dey expected to be anoda busy travel day.

Wia dis foto come from, Getty Images
On Thursday dem delay more dan 2,500 flights wey wan go within, into or out of di US and dem bin cancel more dan 400 flight, according to Flightaware.com.
Hundreds of thousands of pipo neva still get light afta di severe weather wey hit both coasts of di United States during di Thanksgiving holiday.
Pennsylvania na di state wey face di worse power cuts early on Friday, according to monitoring site Poweroutage.us.
One passenger bin tell di BBC say im bin hang for New York LaGuardia Airport for 13 hours wen im bin dey try to fly to see friends for Chicago for Thanksgiving.
Beyond di travel wey scata pipo plans, di impacts spread well-well across di East Coast, and US President Donald Trump say im go consider to release emergency funds.
Dem close different bridge for Maryland due to di severe winds, while waves scata different beach for Delaware as water cross enta di boardwalk.
For di wettest Thanksgiving for di record for Washington DC, tidal waters increase and soak runways for Reagan Washington National Airport.
Parts of some states dey under states of emergency, including New York.
Nearly 2in (5cm) of rain fell on New York City iconic Central Park, wey make am di wettest Thanksgiving on record for dat site as well, according to preliminary data from di NWS.
Organisers of di city annual Macy Thanksgiving parade also suffer as dem push back di event to Saturday - wey be di first time dem dey postpone di event for di 100-year history.
For neighbouring New Jersey, were multiple reports of closed roads and bridges, and images of floodwater wey cover streets for di city dey
"E dey wild," an Ocean City, na wetin New Jersey-based blogger tok for video wey e bin post on social media, as im bin dey waka inside water wey dey splash above im waist.
Di number of homes wey report say dem no get light dey close to one million on Thursday evening - Pennsylvania, Virginia, Maryland and New Jersey dey among dos wey dey badly affected.
Pennsylvania Governor Josh Shapiro say utility providers dey work tirelessly to restore power.
For Maryland, authorities tell almost two million customers to limit how dem dey use water for essential use only due to "power disruptions wey no dey stable".
Di storm dey expected to reduce on Friday and e go move enta di Canadian provinces of Nova Scotia and Newfoundland on Saturday, wey go make di weekend dry well-well for di north-eastern United States, according to di Met Office.
However, another deep area of low pressure go likely arrive on Monday - wey fit bring anoda set of heavy rain and strong winds, and some further travel disruption.






















