Five key lessons Inec mock accreditation exercise reveal about commission readiness for 2027 election

One Inec official dey capture one voter during di Inec mock accreditation exercise wey hold on Saturday, 28 November for Lagos state
Wetin we call dis foto, One Inec official dey capture one voter during di Inec mock accreditation exercise wey hold on Saturday, 28 November for Lagos state
Published
Read am in 7 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don test dia electoral technology and operational readiness ahead of di 2027 general elections through one nationwide mock accreditation and voting exercise.

Di exercise, wey dem carry out on Saturday, 28 November across selected polling units across di kontri na to assess di how di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) take dey function, test accreditation procedures and to know how prepared di commission dey for di forthcoming general elections.

BBC News bin cover some polling units across Lagos, FCT, Kano, Oyo, states among odas and report say di exercise record low voter turnout for some areas, electoral officials and materials no reach some polling units early, lack of communication between di commission and di voters, also some polling units experience technical challenges wey affect di accreditation process.

Dis na some of di lessons from di exercise.

Low turnout across several states

Inec 2027 mock accreditation exercise

Low participation of voters for several locations, wey include Lagos, FCT, Oyo, Anambra, among odas.

For Lagos, Polling Unit 002, Holy Cross Ward D3, Popo Aguda, voter turnout no really encourage, even though Inec officials arrive and start di process early.

For Polling Unit 001, Ward 12, Popo Aguda, INEC officials arrive, but voter participation still remain low.

Electoral officials arrive early for di polling units for Lagos Island, but voter turnout dey generally low.

Some voters say dem receive text messages from Inec wey invite dem to participate for di exercise, while some others say dem no even know say di exercise dey happen.

However, di situation dey different for Kano state, as di turnout of voters dey high but most of dem bin tink say na di election proper, as dem dey request wia di political parties dem wan vote dey.

For Polling unit 19-18-22 & 23, for Kabuga Primary School I & II, wey dey Gwale local govment area, plenty pipo turn up for di exercise.

For some pipo, di accreditation go well, while oda pipo get difficulty to verify dem through BVAS.

As tins dey now, plenty pipo, especially women, dey come out to cast dia vote for di mock accreditation wey dey happin across di kontri.

Some civil society organisations wey dey monitor di exercise don also express concern over wetin dem describe as inadequate mobilisation of voters ahead of di mock election.

Another tin wey BBC News Pidgin observe for di polling units dem visit na say, no political party representatives dey present.

Challenge wit results capture, upload and public viewing

Hand hold di BVAS

Di accreditation exercise bin face technical challenge as electoral officers bin dey try to upload election result for Polling Unit 018, Area 10, Abuja Municipal Area Council (AMAC), for di Federal Capital Territory.

Di wahala happun afta election officials don finish sorting and counting of ballot papers, as dem dey try upload di result to INEC Result Viewing Portal (IReV).

Di Biometric Voter Accreditation System (BVAS) reportedly malfunction during di upload process, wey make officials no fit transmit di result for more dan 15 minutes.

Di technical problem don raise concern among election observers wey dey monitor di exercise, as some of dem express dissatisfaction over di malfunction and question whether similar wahala fit affect di conduct of di 2027 general election.

Some observers say technical challenges during result upload fit undermine pipo confidence for di electoral process, if di commission no address am properly bifor di next general election.

Elections observers wey follow di exercise also report say, for Polling Unit 018, Garki Ward 01, officials bin experience difficulties in capturing di image of Form EC8A wit BVAS.

For dis polling unit, e take more dan 30mins to upload di image of di Form EC8A afta several tries.

Dem note say di foto dem capture improve wen dem put di sheet on dark surface.

One of di mock political parties dem list on di paper Form EC8A also miss from di electronic EC8A. Dis mismatch bin lead to incorrect electronic vote total and e delay di upload.

For Polling Unit 020, Wuse Ward 04, Bannex Plaza Junction, observers report say di BVAS bin take at least 30 minutes to capture di results sheet.

Security presence, access restrictions and reported delays in deployment

Policemen near police trucks

Di presence of security agencies full ground for some polling units wey di Inec mock accreditation exercise bin hold across Nigeria.

For Lagos state, di state Commissioner of Police, Tijani Fatai bin do security check around Lagos, as di mock election exercise dey go on.

E tok sey no gbege don happen so far, but e no fit do correct tok tok for now sake of say e still dey check oda polling units.

For Kano state, security also tight for di polling units BBC News Pidgin monitor and no report of any wahala.

Heavy security presence also dey on ground for di FCT to maintain law and order throughout di exercise.

Situation Room also observe say security personnel full ground for most of di polling units dem observe.

BVAS functionality

BVAS

INEC deploy electronic Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) machines for di exercise, but no ballot boxes dey ground for di polling units.

For Kano state, some pipo complain say di machine dey slow, also e bin dey difficult to verify some voters through BVAS.

Election monitoring body, Yiaga Africa for statement tok say di BVAS bin function well for some polling units dem observe.

"For 68% of polling units, di average voter processing time wey use d BVAS na between 1–2 minutes. For 27% of polling units, di average voter processing time wey use di BVAS dey between 3–5 minutes. For 4% of polling units, di average time to process a voter using di BVAS bin dey between 6–10 minutes" Yiaga Africa tok.

Di body, however record technical challenges for some locations. Dem say for Oshin Ladega Polling Unit, Agbala Ward, Ikorodu LGA, Yiaga Africa observed say Inec officials come wit two BVAS devices instead of di three wey dey expected.

Also, some voters wey dia names show on di voter register no fit dey authenticated using di BVAS.

"For Gumbi/Wajake Yar Abba (PU 33-21-03-009), Wamakko LGA, one BVAS wey malfunction bin scata di accreditation exercise for almost one hour."

Also, for Maternity Ogunsola Filling Station (PU 003), Ijero Ward A, Ijero LGA, one of di two BVAS devices electoral officials bring malfunction and e affect accreditation for voters wey dey assigned to di device.

Low sensitization, changes in polling units, late arrival of election materials

BBC News Pidgin report say for some polling units Inec officials bin arrive late. Di mock accreditation wey suppose start as 8:30am, no start until 9:30 for some units.

Also, electoral materials for di exercise no dey available for some units.

Changes in polling units na challenge for some pipo wey neva collect dia Permanent Voters Card (PVC) as dem no dey informed say BVAS fit still capture dem during di mork exercise.

For Polling Unit 006, Ward D2, Oluchi Kakawa, plenty residents bin come out to participate, but BVAS no fit confa some voters becos dem discover say dia polling units don change.

Meanwhile, Yiaga Africa observe significant delays in di commencement of di exercise sake of late deployment of election personnel and materials.

"By 9:30 a.m., di exercise bin start for only 36% of observed polling units, e increase to 64% by 10:00 a.m. Some polling units no start several hours later.

"For Fadan Karshi I (PU 18-20-02-001), Sanga LGA, Kaduna State, Inec officials land around 1:40 p.m., while for Wanikde Playground (PU 09-18-08- 004), Wanikde Ward, Yala LGA, Cross River State, election officials neva arrive as at1:30 p.m.," di monitoring organization tok.

Di late deployment of materials bin also affect di conduct of di exercise for Effraya International Market Polling Unit, Effraya Ward, Etung LGA, Inec officials arrive without voting materials.

For several polling units dem visit for FCT, observers report di absence of materials like polling booths, ballot boxes, indelible ink and stamps.