Some prominent traditional rulers wey don chop suspension bifor for Northern Nigeria

Some big traditional rulers for Northern Nigeria wey dem don suspend before.
    • Author, Aminu Kutama
    • Author, Abdulrazzaq Kumo
  • Published
  • Read am in 7 mins

For history of Northern Nigeria, plenty times we don see emirs and oda traditional rulers lose dia throne or face suspension becos of disagreement wit di govment, power tussle or allegations about how dem dey carry out dia duties.

Even though traditional rulers get plenty respect for society, govment hold power to approve appointment of emirs or remove dem from throne don make di relationship between govment and traditional institutions complicated many times.

For recent years, some traditional rulers for different parts of Northern Nigeria don face suspension or removal because of allegations of abuse of power, breaking of laws, political interference and other issues wey cause controversy.

BBC tok to historians Ibrahim Ado Kurawa and Dr Tijjani Naniya to find out about some traditional rulers for Northern Nigeria wey govment don suspend or dethrone before.

Emir of Daura - Muhammadu Bashar

Mohammad Bashar
Wetin we call dis foto, Mohammad Bashar

Dem appoint Alhaji Muhammadu Bashar as di 59th Emir of Daura on 18 June, 1966. But one interesting thing be say, shortly afta e ascend di throne for dat same year, military govment suspend am.

Dem take di decision to carry out special investigation into financial and administrative activities of Northern Region Marketing Boards and di Northern Nigeria Development Company (NNDC), wey dey under his supervision when e serve as minister before dem appoint am Emir of Daura.

But afta di committee wey govment set up finish the investigation, dem clear Alhaji Muhammadu Bashar of all the allegations against am. Military government later restore am to the throne of Daura for 1968, and e continue to rule until e die on 28 February, 2007.

Emir of Kano - Ado Bayero

ADO BAYERO
Wetin we call dis foto, Marigayi Sarkin Kano Ado Abdullahi Bayero

Di 13 emir of Kano, Ado Bayero dey among di emirs wey govment don ever suspend for Northern Nigeria. Suspension wey e face follow one visit wey e make go Israel for 1984, together wit Ooni of Ife wey be Oba Okunade Sijuwade for dat time.

Historian Ibrahim Ado Kurawa tok say di visit no go down well wit Nigerian government dat time, because Nigeria and Israel no get good diplomatic relationship because of some international political reasons.

After dem return Nigeria, government suspend both of dem for six months and ban dem from travelling.

Leta, govment restore dem back to dia positions after di suspension period finish.

Another disagreement also happen between late Emir of Kano, Ado Bayero, and di civilian governor of Kano State dat time, late Abubakar Rimi.

Dia disagreement na over royal greetings and di authority to manage palace affairs. As punishment, late Abubakar Rimi send query to di Emir and later suspend am from di position of Emir of Kano.

Di decision wey late Abubakar Rimi take cause protest and serious unrest for Kano in July 1981. Na after dat crisis government create some new emirates for Kano, but dem later abolish di emirates afta late Sabo Bakin Zuwo become Emir of Kano.

Emir of Daura - Umar Faruk

EMIR OF DAURA

Di recent na di suspension of Emir of Daura Alhaji Umar Faruk Umar by di Katsina state government ova allegation to sexual harassment of one oyibo tourist.

For one video wey di woman post, dem see her inside one palace wey resemble Hausa traditional palace, together wit one man wey people believe say na Sarkin Daura, Alhaji Umar Faruk Umar.

For di video, di woman, wey introduce herself as Beduina for her Instagram page, talk say: "One of di things wey impress me na to hear di history of Daura, because women na dem dey rule Daura in di past."

Under di video wey she post, di woman explain say she record am wit di camera wey dey inside di glasses wey she wear, wey dem dey call Meta glasses.

She say di incident happen for November 2026, when she come Nigeria for tourism.

Emir of Birnin Yandoton Zamfara

For 2022, Zamfara State govment for Northern Nigeria suspend di Emir of Yandoto Daji after e give di notorious bandit, Adamu Aliero, di title of Sarkin Fulani.

Govment announce di suspension for one statement wey e release on Sunday, 17 June 2022, where e say e no get knowledge of di appointment wey dem give Adamu Aliero, wey Nigerian security agencies dey search for.

Govment hand over di temporary control of di traditional ruler's office to Alhaji Mahe Garba Marafa, wey be Hakimi of Yandoto.

But later, government restore am back to his position afta di committee wey dem set up to investigate di matter clear am of di allegations against am.

Emir of Lame - Aliyu Yakubu

His Royal Highness, di Emir of Lame, Alhaji Aliyu Yakubu Lame.

His Royal Highness, di emir of Lame, Alhaji Aliyu Yakubu Lame di among di traditional rulers wey government don ever suspend.

Bauchi State government, under govnor Bala Mohammed, suspend His Royal Highness, di traditional ruler of Lame, Alhaji Aliyu Yakubu Lame, from his position wit immediate effect.

The suspension follow allegations say di traditional ruler dey collect illegal tax, dey interfere for land allocation without approval, and dey disturb di activities of mining companies for di area wey his emirate cover, according to di government.

For one statement wey govment release on 14 November, 2026, dem say di suspension na temporary measure, to allow authorities carry out proper investigation without interference.

Govnor Bala Mohammed don set up 12-member investigative committee, and give dem three weeks to investigate di allegations and submit report together with recommendations to di govment.

Govment also direct di Galadima of Lame, Alhaji Bala Abubakar, to continue to oversee di administrative affairs of the emirate.

Emir of Gwandu - Haruna Jokolo

On 3 June, 2005 di Governor Kebbi State for that time, Adamu Aliero, dethrone Sarkin Gwandu, Alhaji Al-Mustapha Haruna Jokolo, ova allegations say e make statements wey dey cause wahala.

Di dethronement happen afta di state government accuse am of making statements wey dem say fit pose "threat to national security."

But for 2014 and 2016, Kebbi State High Court and Court of Appeal overtun di dethronement. However, Nigeria Supreme Court later uphold Kebbi State government decision to remove di Emir for June 2025.

Emir of Maru - Abubakar Chika

Emir of Maru Abubakar Chika
Wetin we call dis foto, Emir of Maru Abubakar Chika

Emir of Maru, Abubakar Chika, dey among traditional rulers wey Zamfara PDP government first suspend and later remove from throne ova allegations say e get hand for di insecurity wey dey affect di state.

For August 2019, Bello Matawalle government remove di emir of Maru, Abubakar Chika, over allegations say e betray him people through his alleged relationship wit bandits wey dey kill people and kidnap dem.

Zamfara State government say e remove di Emir afta di committee wey dem set up to investigate allegations say some traditional rulers dey involved in banditry and kidnapping found Sarkin Maru "directly involved" in di matter.

Government first suspend di traditional ruler afta some of his people accuse am of having links wit people wey dey kidnap others.

But di Emir's camp deny all di allegations against am.

Apart from emirs, some community leaders and village heads also don face suspension ova allegations say dem get hand for banditry.

Emir of Zurmi - Atiku Abubakar

Atiku Abubakar
Wetin we call dis foto, Atiku Abubakar

Emir of Zurmi, Atiku Abubakar also dey among traditional rulers wey former Zamfara State governor, Muhammad Bello Matawalle, suspend ova allegations say e get hand for di killings wey bandits dey carry out for di area wey his emirate cover.

Dem suspend am afta government set up one committee, under di leadership of former deputy governor Ibrahim Wakkala, to investigate di allegations against di traditional ruler.

Government direct Bunun Kanwa, Bello Suleiman, to take ova di leadership of di emirate immediately.