Nollywood icon die: Life and times of ogbonge Nigerian actor Pete Edochie

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG
Ogbonge Nollywood actor Pete Edochie na one of di most respected actor wey Nigeria and Africa don produce.
Pipo sabi am well-well sake of im deep voice, im strong character, wisdom, di way e take dey use African proverbs, and di correct way e take dey deliver im roles for feems wey mostly be di role of traditional ruler, father, king, chief and community leader.
Edochie no be just entertainer, e don bicom symbol of African culture, tradition, authority and storytelling.
One interesting tin about im life be say bifor e become big name for acting, e don already make name for broadcasting.
Dem born Pete Edochie wey im real name na Peter Uwadiegwu Ogugua Edochie on 7 March 1947.
E hail from Anambra State, southeast Nigeria. Di veteran actor also na traditional title holder, e be di IBOBO 1 Umueri Kingdom.
Bifor e bicom di respected and famous Nollywood actor wey many pipo bin come to know now, Edochie bin start im career for di broadcast industry.
For 1967, Edochie join di Eastern Nigerian Broadcasting Corporation (ENBC) as junior programmes assistant. E later rise for di profession to di position of senior broadcasting executive.
For 1980, e travel go UK to get more professional training from di British Broadcasting Corporation (BBC).
E also work wit Anambra Broadcasting Service, wia e later bicom di Director of Programmes and e hold oda important managerial positions.
On how im acting journey take start, Edochie begin act many years ago for di 1960s, bifor Nollywood bicom di name wey evribody know am as today.

















