National Universities Commission raise alarm over activities of two foreign universities

Di Executive Secretary of National University Commission Prof. Abdullahi Yusufu Ribadu
Published
Read am in 5 mins

Nigeria Universities Commission (NUC) don declare di activities of two international educational institutions wey dey operate for Nigeria illegal.

NUC for one statement on Tuesday allege say di London College of Management and Leadership Education (LCMLE), United Kingdom and di University of America Curacao dey operate illegally and no dey authorised to award recognised university degrees for Nigeria.

Dis dey come as di London College of Management and Leadership Education dey prepare for dia 2026 Convocation and Graduate Ceremony for Abuja, di kontri capital, wia dem go confer awards to pipo wey graduate from di college for one ceremony dem schedule for 11December, for di NAF Conference Center.

BBC News Pidgin don reach out to di institutions for comment but dem neva respond.

University of America, Curacao dey operate illegally - NUC

For statement wey di commission director for public affairs, Rita Okonjo issue, she allege say di University of America, Curacao dey admit students, run academic programmes and award degrees through unauthorised campuses and learning centres for Nigeria.

Dis centres include Cosmopolitan International Business School (CIBS), Garki, Abuja, dia purported FCT Learning Centre, and di University of America College of Science and Technology (UAPOLY), Ekpoma, Edo State, NUC add.

Di commission make am clear say, "neither di University nor dis establishments dey approved by di NUC to operate or award degrees for Nigeria.

Dem add say investigations don show say di University no dey accredited by any agency recognised by di United States Department of Education or di Council for Higher Education Accreditation (CHEA).

"Di claim say e dey listed for di Integrated Postsecondary Education Data System (IPEDS) and say e register for California and Florida, no mean say di school get proper accreditation or legal power to award recognised university degrees.

"In di same way, di claims say di school get approval from Federal Ministry of Education, JAMB, NBTE, and Nursing and Midwifery Council of Nigeria no give am authority to operate as a university or award degree certificates for Nigeria," di statement tok.

Di commission also say dem dey worry as di institution dey advertise say dem dey offer programmes in Law, Nursing Science, Engineering, Pharmaceutical Science, Aerospace and Rocket Engineering, and postgraduate studies, wey include Ph.D. degrees.

Dem also dey promise dia students NYSC mobilisation, professional recognition and Green Cards to live and work for di United States or Europe.

NUC clear am say na fake and qualifications wey anybody get from unapproved institutions no dey recognised for NYSC mobilisation.

Dem add say di use of reputable public institutions as venues for ceremonies dno mean endorsement or confer legitimacy on an unapproved university.

Di commission don sama warning to prospective students to avoid di university and all di centres and affiliates for Nigeria.

Meanwhile, according to di informate of di University of America, Curuca website, dem don dey in operation four decades and na di Government of Curacao (License no: OFS 0649/2019) give dem licence to operate.

From di informate on di school website, dem get approval to award all academic degrees and titles by di Royal Charter wey di Prime Minister and Minister of Education, Science, Culture & Sports, Curacao grant am.

Di university na classical and transnational Dutch-American educational institution wey dey based for Curacao, Kingdom of di Netherlands, and e get roots for Baptist traditions.

Dem say dem dey serve humanity by granting access to affordable and quality university education to all qualified persons for evri part of di world without regards to their national, gender, racial , social, political, philosophical, economic status or religious creed.

Dem also dey offer undergraduate degrees (Associate and Bachelor's), Master's degrees, and Doctoral degrees across eight schools and faculties.

Di university na hybrid and distance-learning institution wey dey based for Willemstad, Curaçao.

LCMLE no dey authorised to award university degrees in Nigeria - NUC

For similar development, di NUC don cut warning give Nigerians say di London College of Management and Leadership Education no be recognised higher education institution for di UK, and dem no dey authorised to award recognised university degrees in Nigeria.

Dem advise kontri pipo, especially lecturers, public office holders and oda professionals say make dem ignore any award or certificate wey LCLME dey offer.

"Dia registration as a private company wit di UK Companies House no confer any academic recognition or degree-awarding authority."

Di commission say dem dey worry as di College dey make money from academic qualifications and titles, wit advertised prices for Professorship, Associate Professorship, Honorary Doctorates plus oda awards.

Dem warn say di use of degrees and academic titles from dis university to find employment, promotion or professional recognition for Nigerian universities and di public service fit attract appropriate consequences.

London College of Management and Leadership Education on dia website claim say dem get 900 candidates and ova 1,000 alumni.

Di institution claim to be "globally recognised institution wey dedicated to empowering leaders across various sectors. Designed for political, corporate, and academic leaders".

Dem dey offer 40 courses and na online programme.