Trump, Putin and Xi meet for historic talks for China

Donald Trump, Xi Jinping and Vladmir Putin shake hands
Wetin we call dis foto, After one warm reception from Xi, di leaders of di US and Russia shake hands ahead of one reception
Published
Read am in 4 mins

Donald Trump and Vladimir Putin don meet for di first time in ova one year on Wednesday, as di two of dem dey prepare for landmark discussion for China wit Xi Jinping.

Di Chinese leader greet di US president as e come down from im plane wen e land Shenzhen for one summit of Asia-Pacific leaders, wey go end for inside one closely-watched meeting between di two of dem and di Russian president.

Afta one carefully choreographed handshake and hug between Trump and Xi on di tarmac, di US president later greet and exchange pleasantries wit Putin ahead of a reception.

Trump and Putin dey expected to hold one-on-one talks on di sidelines of di summit on Thursday, wia dem go discuss di conflict for Ukraine.

However, di main focus during di Asia Pacific Economic Cooperation forum (Apec) go be on di US-China-Russia talks on Thursday - di first time di three leaders go meet togeda in person.

Dem neva make di full agenda of di meeting public, but different hints dey about wetin dem fit discuss, including di conflicts for Ukraine and Iran, nuclear production, trade tensions and developments in artificial intelligence.

E neva dey clear on Wednesday di kain form wey separate Trump-Putin talks go take, though one Kremlin tok-tok pesin indicate say short informal talks fit happun without large delegations for di room.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky don raise fears of plan to end di war dem go discuss for di absence of representatives from Kyiv or Europe.

Wednesday handshake na di first in-person meeting between Trump and Putin since August 2025, wen di Russian leader travel go Alaska for talks on di Ukraine war wey fail to deliver a breakthrough.

Xi personal reception for Trump for di airport bin mimic one similar move by di US president wen di Chinese leader bin visit Washington for September, one gesture Xi describe as "special".

Dem roll out one red carpet for Trump for front of Air Force One, crowd dey hail am, honour guard, military flyover and flowers presentation all dey in place to welcome am.

Chinese state-run news agency Xinhua wey quote Xi say e wan pursue a "constructive strategic and stable relationship based on respect, fairness, and equality".

Dem go see Xi greeting as one diplomatic gesture dem design to begin di week talks wit im American counterpart on a cordial note.

Donald Trump and Xi Jinping
Wetin we call dis foto, Dem throw one lavish welcome ceremony for Trump arrival

Dem dey hold di Apec summit for Shenzhen, south-east China, one booming area for manufacturing and advanced tech.

E dey come afta dem remove Nvidia chief executive Jensen Huang, wey admit say im get affair wit one woman US intelligence suspect say dey spy for Beijing - one claim wey China don dismiss as "smear".

Trump don pursue warmer relations wit China but di incident point to ongoing tensions between di two powers.

Several hours before Trump arrival, Putin land for Shenzhen and hold around two hours of talks wit Xi, wey im don press for closer economic and defence relations.

Xi tok say both countries go "move forward steadily and boldly" and say di relationship dey "stable as a mountain, unshaken by storms".