Na hia we go draw di curtain for di Inec mock election exercise.
Tank you say una dey wit us for dis live coverage of di Inec mock election exercise!
Inec dey conduct mock accreditation and result upload exercise across polling for Nigeria for di 2027 general elections.
Adesola Ikulajolu, Sarah Ayeku, Atsahyel Aaron, Kingsley Onwuka, Abubakar Maccido
Na hia we go draw di curtain for di Inec mock election exercise.
Tank you say una dey wit us for dis live coverage of di Inec mock election exercise!

Wia dis foto come from, Inec/X
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don begin upload results of di 2026 mock accreditation exercise on top dia Result Viewing Portal (IReV).
Out of di 17614 polling units wia di accreditation exercise bin hold, di Irev don record 2068.
Di exercise wey bin hold nationwide on Saturday 28 November, bin dey expected to start by 8:30am and end by 2:30pm.
BBC News Pidgin report say di exercise don end for Lagos, FCT, plus oda state across di kotri and counting don start.

Independent National Electoral Commission (INEC) don face technical wahala as dem dey try upload election result for Polling Unit 018, Area 10, Abuja Municipal Area Council (AMAC), during Saturday mock election exercise for Federal Capital Territory.
Di wahala happun after election officials don finish sorting and counting of ballot papers, as dem dey try upload di result to INEC Result Viewing Portal (IReV).
Di Biometric Voter Accreditation System (BVAS) reportedly malfunction during di upload process, wey make officials unable to transmit di result for more than 15 minutes.
Di technical problem don raise concern among election observers wey dey monitor di exercise, as some of dem express dissatisfaction over di malfunction and question whether similar wahala fit affect di conduct of di 2027 general election.
Some observers say technical challenges during result upload fit undermine people confidence for di electoral process if INEC no address am properly before di next general election.
Di mock election na part of INEC preparations and testing of its electoral processes and technology ahead of di 2027 general elections.

Mock election don finish for parts of Lagos as INEC, voters and security officials don test dia readiness for 2027 election.
Voters wey BBC follow tok say dem no get plenti informate about di election, dia polling unit and wen dem go fit collect dia permanent voters card so dem go dey ready for di mock exercise.
For some pipo wey do accreditation, dem tok say di process dey smooth and peaceful.
No be only INEC dey check if dem don ready, political party agents wey dey ground tok say dem go use di mock election check dia popularity for di election.

For some parts of Abuja, counting of ballot dey go on.
For Area 10 Garki Abuja municipal area council counting and upload dey go on as Inec conduct mock election exercise ahead of 2027 general elections.
Di mock election exercise, suppose take place between 8:30am and 2:30pm.
Now, di voting don end and na counting dey go on.




Yiaga Africa don call Inec attention for matta wey involve conflicting figures for iRev and di one dem release di week.
Di organisation say di number released by Inec no tally and make dem address am sharply.
Yiaga na organisation wey dey put eyes for election matter.
Yiaga add say di number of polling units for IReV no match di official figure wey Inec release, according to dia post for X.

Inec announce say dem dey carry out di exercise for two polling units for each of di kontri 8,838 Registration Areas, wey bring di total to 17,676 polling units.
Di selected polling units cut across di 36 states plus di Federal Capital Territory.
Breakdown of di selected polling units show say Kano state get di highest number, followed by Katsina and Oyo states.
Kano - 968
Katsina - 718
Oyo - 702
Osun - 664
Akwa Ibom - 658
Anambra - 652
Rivers - 638
Borno - 622
Imo - 610
Osun -
Jigawa - 574
For states wey get di lowest polling units include di Federal Capital Territory, followed by Bayelsa and Gombe states.
FCT - 124
Bayelsa - 210
Gombe - 228.
For di North-West, Kano lead wit 968 polling units, followed by Katsina wit 718 and Jigawa state wit 574.
For di South-West, Oyo lead wit 702, followed by Osun wit 664 and Lagos wit 490.
Akwa Ibom get di highest number for di South-South wit 658, followed by Rivers wit 638 and Delta wit 598.
Anambra lead di South-East wit 652, followed by Imo wit 610 and Enugu wit 520.
For di North-Central, Benue get di highest number wit 552, followed by Niger wit 548 and Kogi wit 478.
Borno state lead di North-East wit 622, followed by Adamawa wit 452 and Bauchi wit 424.

From di Federal Capital Territory (FCT), Abuja, Lagos, Oyo, Osun, Kano states, and across Nigeria, eligible voters turn out for di Inec mock accreditation exercise ahead of di 2027 election.






Wia dis foto come from, John Alabi/BBC
Dis na polling unit 20 New Eden School Mokola, ward 9, Ibadan North LGA unit 20. Ibadan, Oyo state.
Di mock election start around 10:22am.

Wia dis foto come from, John Alabi/BBC

Wia dis foto come from, John Alabi/BBC

Di mock exercise dey happen for PU: 002 and 004 ward 03 Danbare Primary school inside Kumbotso local government area of Kano State
Di exercise start afta 10:00am for Danbari Primary School.
Earlier today, wen BBC News Pidgin visit di polling unit, none of di Inec staff bin dey present.
But as tins dey now, accreditation don start. Plenty pipo turn up for dis polling unit. Security personnel still dey present for di polling unit to make sure say evritin go as planned.
One tin wey BBC News Pidgin notice be say some voters no understand how di mock accreditation dey work.
Dem dey ask Inec staff about di political parties wey dem expect to see for di ballot paper but dem no fit find.
Di inec mock exercise dey go on for different polling units across Nigeria Federal Capital Territory (FCT), including Polling Units 020, 018 and 111 for Abuja Municipal Area Council.
For polling units wey we visit, election officials arrive as early as 8:00am to prepare for di exercise and receive voters.
But voter turnout dey low for the polling units wey we don visit so far.
Some residents say dem receive text messages from Inec wey invite dem to take part for di exercise, while some others say dem no even know say di exercise dey happen.
Some civil society organisations wey dey monitor di exercise don also express concern over wetin dem describe as inadequate mobilisation of voters ahead of di mock election.
Another tin wey we observe for di polling units wey we visit na say no political party representatives dey present.
Inec deploy electronic Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) machines for di exercise, but no ballot boxes dey ground for di polling units.
Dis raise questions about di commission preparedness for di simulation.
As e speak to BBC, Assistant Presiding Officer, Chielo Sochima, describe di process as seamless, say Inec no see di need to deploy ballot boxes for di mock exercise.
E defend di commission decision, adding say more voter sensitisation go dey happen for polling units ahead of di general elections.
Heavy security presence also dey ground for di polling units wey we visit, as security operatives dey deployed to maintain law and order throughout di exercise.

Di Independent National Electoral Commission (Inec) mock accreditation exercise ahead of di 2027 general election don start for Oyo state, southwest Nigeria.
Di exercise bin start around 10:22am for Ward 9, Ibadan North unit 20. New Eden School Mokola, Ibadan.
Di exercise also dey go on for Apete Ido local govment, Ward 4.
Eligible voters bin turn out for di exercise and BBC observe how di Inec adhoc staff dey try use Bvas to capture dem and dia thumbprint.

Di mock exercise start around 10:00am for Kabuga Primary School, Kano State.
For PU 19-18-22 & 23, for Kabuga Primary School I & II, wey dey Gwale Local Govment Area of Kano State, pipo, men and women turn up to participate for di mock accreditation wey dey hapun across di kontri..
For some pipo, di accreditation go well, while oda pipo get difficulty to verify dem through BVAS.
Security personnel also present to make sure say evritin dey go well.

Wia dis foto come from, Sarah Ayeku/BBC
Lagos Commissioner of Police, Tijani Fatai do security check around Lagos, as di mock election exercise dey go on.
E tok sey no gbege don happen so far, but e no fit do correct tok tok for now sake of say e still dey check oda polling units.
Meanwhile, Lagos pipo begin late for different polling units.
For one polling unit wey we monitor for Ojodu area, polling unit 021, wen accreditation start some pipo wey don dey vote for dis place no see dia name for di register, even though na here dem vote for di last election.
Na only two INEC official, about eight police officer plus one NSCDC person dey dis unit.

Wia dis foto come from, Sarah Ayeku/BBC

Wia dis foto come from, Sarah Ayeku/BBC
INEC dey conduct mock election exercise wey dem wan use test dia machine and equipment ahead of di 2027 general elections.
For 002 polling unit Holy Cross Ward D3 Popoaguda Lagos Island LGA, INEC pipo start late becos pipo wey suppose participate for di exercise first dem come.
Wetin BBC witness na say pipo wey never collect dia PVC becos dey register dis year, di machine capture dem and dem participate for di exercise.
One party agent wey suppose act as observer for today exercise say if INEC fit maintain dis pattern dem bring today for di mock election, e mean say 2027 elections go dey smooth.
He add say INEC pipo come late, but as Dey arrive pipo wey suppose come participate start de come out.
Dis na how mock accreditation exercise dey go on for polling unit 006 Ward D2, Oluchi Kakawa Lagos Island LGA.

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC

Wia dis foto come from, Abubakar Maccido/BBC
For Kano, di INEC mock exercis dey also happun as pipo come out to test di machines.
BBC Pidgin monitor polling units 19, 18, 22 and 23, Kabuga Primary School I & II, Kabuga, Gwale local govment area of Kano state.
We see say women come out well well as dem take turn to do accreditation.
Meanwhile, some of dem complain say di machine now really fast. Dem say di process too slow.

Wia dis foto come from, Abubakar Maccido/BBC

Wia dis foto come from, Abubakar Maccido/BBC

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC
Inec mock election exercise wey dem wan use test dia machine and equipment ahead of di 2027 general elections don start for Lagos state.
For 002 polling unit Holy Cross, Ward D 3 Popoaguda, Lagos Island LGA, Inec pipo start late becos pipo wey suppose participate for di exercise first dem come.
Wetin BBC witness na say some pipo neva collect dia PVC becos dey register dis year.
Meanwhile, di machine dey capture dose wey get PVC and dey participate for di exercise.
One observer for today exercise say if Inec fit maintain dis pattern dey bring today for di mock election, e mean say 2027 elections go dey smooth.
E say, although INEC pipo come late, but as dem arrive pipo wey suppose come participate start dey come out.

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC

Wia dis foto come from, Kingsley Onwuka/BBC
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don begin nationwide mock accreditation and result upload exercise wey dey scheduled for Saturday, 28 November.
Inec list 17,656 polling units across di 36 states and di Federal Capital Territory wia di mock exercise dey sup.
Di exercise, wey go take place between 8:30am and 2:30pm, na part of di electoral body preparations for di 2027 general elections.
According to Inec, dem say di exercise go hold for two polling units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide.