Lagos mourn as dem lay former govnor and Nigerian senator Idiat Adebule to rest

Wia dis foto come from, Senator Idiat Oluranti/X
Di Lagos state chapter of di All Progressives Congress (APC) don suspend all campaign activities across di state following di death of Senator Idiat Oluranti Adebule, as political leaders, former colleagues and party members continue to mourn di former Lagos deputy govnor ahead of her burial wey go hold on Sunday, 29 November.
Adebule, wey bin represent Lagos West Senatorial District for di National Assembly, die on Saturday, 28 November 28 at di age of 56, a day afta she celebrate her birthday.
Dem go bury her remains today for Ebony Vaults and Gardens, Ikoyi, Lagos, by 3pm, according to di tok-tok pesin of di Lagos APC, Seye Oladejo wey announce her burial date for statement e issue on Saturday.
According to di statement, party leaders, elected representatives, stakeholders, members and supporters dey expected to attend.
Di Lagos APC announce di suspension of campaign activities through statement wey di party state spokesperson, Seye Oladejo, issue. Di Director-General of Lagos State APC PBAT/KOH Campaign Council, Senator Musiliu Obanikoro, also direct say make all campaign activities stop until further notice.
According to di party, dem take di decision because of di grief wey don surround di party following her death and to give di late senator di honour and respect wey she deserve because of her contributions to public service and Lagos State development.
Di party direct all campaign structures, committees, directorates, supporters and stakeholders to obey di directive.
Di Lagos APC also announce say dem don postpone di Lagos West Senatorial District campaign rally wey suppose hold on Monday, November 30, for Police College, Ikeja.

















