US announce new tariff proposals on 14 countries

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States don announce new tariffs on some of dia biggest trade partners wey include China and di European Union.
Di new taxes wey dem charge on imports to America go hit many of di kontri biggest trading partners, wey include China, di European Union plus 12 oda jurisdictions.
Di move dey come afta White House investigation into di trade practices of oda countries for March afta US Supreme Court rule say Trump previously announced Liberation Day tariffs dey illegal.
China dey face di highest rate of "up to 40%", followed by Vietnam wey dey up to 35% and oda countries dey face either 20% or 25%.
Di new duties no dey expected to take effect until next year.
Tariffs na taxes wey govment dey put on top goods wey companies import from abroad.
Dem dey usually calculate di amount wey importer go pay as percentage of di value of di goods, and na di businesses wey dey bring di products enta di kontri dey pay am to di govment.
Some of dis tariff rates go effectively reduce becos of tariff caps wey Donald Trump don agree to.
Different countries also dey face different tariff charges depending on di agreement and policy wey apply to dem.
List of countries wey dey affected
Di list of countries wey di proposed tariffs go affect include:
- China
- Di European Union
- Singapore
- Switzerland
- Indonesia
- Malaysia
- Cambodia
- Thailand
- Korea
- Vietnam
- Taiwan
- Bangladesh
- Japan
- India
However, Canada no dey list. One senior govment official tell tori pipo say Canada no dey for di for di investigation dem carry out.
E add say dat no mean say dis na clean bill of health for Canada.
Di Trump administration don previously hit Canada wit several rounds of tariffs - and some dey as high as 50% on certain exports to US - wey include steel, copper, cars and alcohol.
In response, Canada bin introduce counter tariffs on US goods wey include on metals, seafood and dairy products.
Why US impose di new tariffs

Wia dis foto come from, Getty Images
Jamieson Greer, United States trade representative, tok say di latest tariffs wey dem issue go "level di playing field for American workers and chart a new, more sustainable course for di world economy".
E claim say many of America trading partners "for decades" don adopt industrial strategies wey include "targeting manufacturing, wage and labour suppression" as well as "oda market distorting practices wey dey distort market and make trade favour dem while e dey weaken America manufacturing sector.
But economists don warn say tariffs fit make inflation rise and push prices of goods higher for consumers if businesses transfer di extra costs give customers. Dem also warn say di tariffs fit slow down global trade and affect economic growth.
Trump don repeatedly threaten or impose tariffs during im second term, as e argue say di policy go boost US manufacturing and create jobs.
Even wit di poor result for di Republican party for di mid-term elections, di president don continue to press on wit im flagship trade policy.
Trump also dey seek to cut di US trade deficit - di gap between di value of goods dem dey buy from oda countries and dos wey dey sell am to dem.
Di announcement go likely increase tensions between US and China, di world two biggest economies, wey continue to dey locked in trade dispute and AI race.
US and China still dey face each oda for tariff fight, although dem don pause am for now.
Even afta di meeting wey happun last week between Donald Trump and President Xi Jinping, both sides no make any fresh announcement about di trade war truce, wey go expire on 10 January.
Di European Commission reject di new US tariffs, dem say dem go investigate why America bring dem.
Dem also remind US say di agreement wey dem bin reach bifor na say tariffs no go pass 15%.
Oda times Trump announce tariff on countries
Dis no be di first time wey Trump go sama trading partners wit significant levies.
Shortly afta di president start im second term, e sama tariffs on Canada and Mexico, bifor e impose further measures on China, UK and EU.
Some African countries like Nigeria, Ghana, South Africa, Tunisia, Algeria, Angola among oda also dey affect wit di import tax on goods e impose for August.
Hia na list of times Trump announce tariffs on US trading partners.
1 February 2025 - Trump impose 25% tariffs on Canada and Mexico, and 10% Tariffs on China ova fentanyl smuggling and illegal migration
2 April 2025 - Trump announces so-called "Liberation Day" tariffs. E use emergency powers, wey establish standard 10% levy on all countries wit some as high as 50%
7 August 2025 - Liberation Day tariffs bin come into effect
20 February 2026 - US Supreme Court strike down di tariffs, as di Apex court rule say Trump do pass im authority wen e use emergency powers
24 February 2026 - Afta e lose for court, Trump impose temporary import surcharge of up to 10% on all countries under anoda different law
24 July 2026 - Those tariffs expire, but Trump impose 10% to 12.5% on all goods from di top 60 US trade partners, wey include UK, the EU, China and Africa - dem dey challenge am for court




















