Tinubu approve house, cash gift to families of Nigerian Air Force aircraft crash victims

President Bola Tinubu don announce di sum of N100 million naira each to di families of di 25 Nigerian Air Force personnel and civilians wey die for one military aircraft accident for Igbokoda, Ondo State, south-west Nigeria.
Di Nigerian leader announce dis informate during di memorial service and laying of wreath ceremony to honour di fallen heroes on Thursday, 26 November for di National Cemetery Abuja, di kontri capital.
Tinubu also allocate three-bedroom flat under di Renewed Hope Housing Estate for di Federal Capital Territory to di families of di victims.
E say di housing allocation na demonstration of di kontri gratitude to di fallen personnel plus oda victims wey lost dia lives for di accident.
E say di same honour go extend to immediate families of civilians wey die for di accident too.
During di memorial ceremony, Tinubu tok say e share for di grief of families wey lose dia loved ones, as e add say, di tragedy na "loss for di entire nation".

Na on 5 October, Nigerian Air Force plane (NAF 931) aircraft wey carry 18 personnel and seven civilians bin crash during one routine mission from Benin to Lagos.
Di NAF ATR 42 bin crash crash near one naval base for di Igbokada community.
Di tragedy leave di whole nation in mourning, especially families wey lose dia loved ones for di incident.
Months afta di incident, e still neva dey clear wetin cause di military aircraft crash.
However, di Nigerian leader for di memorial service promise say govment go thoroughly investigate di accident to establish wetin happun, learn from di tragedy and strengthen aviation safety standards and accountability.
Victims of di military aircraft crash

Crew
1. Squadron Leader MI Aburime - (Flight Captain)
2. Squadron Leader AP Man-Ugwueje - (Co-pilot)
3. Flight Lieutenant IS Bako - (Co-pilot)
4. Warrant Officer Abubakar A - (Aircraft Technician)
5. Corporal Uguru HC - (Aircraft Technician)
Passengers
6. Flight Lieutenant - TL Lazarus
7. Flight Lieutenant - M Akinloye
8. Flying Officer IM - Adeshina
9. Master Warrant Officer - Onwuka F
10. Master Warrant Officer - Matini BA
11. Warrant Officer - Nuhu FS
12. Flight Sergeant - James RB
13. Flight Sergeant - Mohammed AI
14. Sergeant - Ani AE
15. Sergeant - Izibenikien SI
16. Sergeant - Alafuka C
17. Sergeant Mbadugha - AN
18. Lance Corporal - Ugwuba FC
19. Lance Corporal - Eledan GE
20. Ezeh Nneka
21. Godstmine Tarabina
22. Joy Michael
23. Sunday Michael
24. Ukeme David
25. Gideon Omotola
Chief of Air Staff assure families of fallen heroes of NAF support

Di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke during di memorial service, tok say di 25 pipo wey die for di crash no be just numbers, but individuals wey get families, friends, dreams and pipo wey dey depend on dem.
Aneke wey express deep sadness ova di accident, say di crash leave di nation and di Nigerian Air Force wit heavy hearts.
"Each name belong to pesin wey we know, cherish and need. Each name call to mind a home, circle of friends, hopes for tomorrow and memories wey nobody fit replace."
Di Chief of Air Staff also extend condolences to di families of di victims, as e acknowledge say no speech or ceremony fit replace di loved ones wey dem lose.
E assure di bereaved families say di Nigerian Air Force go continue to engage dem, provide assistance and treat dia welfare and concerns wit compassion.
Aneke also say di investigation into di crash must establish di facts through thorough, impartial and evidence-based process.
E add say di military no go replace evidence wit speculation.
"Learning from di accident and seeking answers na part of di responsibility di military owe dos wey die and di families wey dem leave behind," e tok.
Di wreath-laying ceremony bring togeda military officials, family members of victims plus oda dignitaries to remember di 25 pipo wey die for di 5 October incident.
Fotos from di memorial service and wreathe-laying ceremony


Wia dis foto come from, Nigerian Air Force/X






















