29 undocumented foreign nationals land inside South Africa detention

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
South African authorities don arrest and detain 29 undocumented immigrants during di two-day operation Shanela wey dem carry out for Tshwane District of di kontri.
South African Police Services (SAPS) on Monday, tok say dem don hand ova di suspects to immigration officials for further investigation.
SAPS tok say dem arrest total of 356 suspects for illegal activities for Mamelodi and Boschkop areas during dia parade for di district ova di weekend.
Na out of di suspects dem find 29 immigrants wey no dey documented, dem put dem inside detention bifor dem come hand dem ova to di immigration officials.
Dis no be di first operation wia South Africa police go arrest illegal migrants.
For September 2026, South Africa reveal say di number of undocumented foreign nationals wey dey don deport so far na almost 90,000.
Di kontri announce say dem don begin put more efforts into how dem go secure dia border and stop foreign nationals wey no get documents to enta.
According to South Africa, dem say dis large number of foreign nationals wey dem deport through repatriations na dose wey no get di right and legal documents to stay for dia kontri.
254 wanted suspects, 29 illegal foreign nationals
According to South Africa authorities dem say dem make arrest of 254 wanted suspects.
"E include three suspects wanted for murder, six for attempted murder, 33 for assault wit di intent to cause grievous bodily harm, five for rape and 91 in connection to gender-based violence-related offences."
"Di multidisciplinary operation happun on Saturday, 31/10, as part of di effort to arrest wanted suspects, address serious and violent crime, stop illegal immigration, disrupt drug-related activities and ensure compliance for liquor establishment."
Di police say di operation also target oda criminal activities wey dey contribute to lawlessness for some areas.
Dem say dis suspects dey in connection wit various criminal offences.
Police say dem arrest one pesin for di possession of drugs and arrest six motorists for driving under di influence of alcohol.
Weti be operation Shanaela for South Africa
South African authorities dey fight organised crime with operation Shanela as dem don arrest ova 17, 583 pipo for various crimes across di kontri for June.
Dem also dey use di operation to enforce some immigration laws across di kontri as dem arrest ova 3,622 illegal migrants during di operations in 2026.
Also, dem arrest ova 1,200 suspects including 159 undocumented foreign nationals wey dem say go against di immigration act for July 2026.
Di police authorities tok say dem pack arrest di undocumented foreign nationals for Gauteng province of South Africa during dia operation shanela for July.
However, many foreigners don express dia concerns as dis arrest dey happun afta di previous protest for undocumented migrants to leave di kontri.
South Africa authoities tok say e no matta di nationality of dose wey dem arrest but dia concern na to ensure say di kontri no get illegal immigrants.
However, Nigeria and Ghana govment don condemn di recent xenophobic attacks against Africans for South Africa as both kontris claims dia citizens dey targeted.
Both kontri don also call on members of di Economic Community of West African States (Ecowas) to dey united to confront di xenophobic attack against black foreigners.



















