UK to outline changes to settlement rules for legal migrants - wetin to expect

Home Secretary Shabana Mahmood carries a red folder as she walks past a grey brick wall.
    • Author, Iain Watson
    • Role, Political correspondent
    • Author, Toby Mann
  • Published
  • Read am in 4 mins

UK Home Secretary Shabana Mahmood go announce her final decision on changes to immigration rules for legal migrants on Monday, 2 November.

But according to di original proposal, e dey possible say most oda workers gatz live and work for UK for 10 years bifor dem go dey eligible for permanent settlement. E fit reduce if dem contribute to dia local communities or get higher incomes.

Mahmood bin propose make di waiting time bifor migrants fit get permanent settlement increase from di current five years to 10 years, while some lower-paid migrants fit wait up to 15 years bifor dem fit qualify.

She explain say di proposal na in response to di period of high net migration wey di UK don experience in recent years.

Di BBC understand say di proposals dey revised for most of di pipo wey currently dey work for social care.

Many lower-paid social care workers bin dey face wait of up to 15 years instead of five.

Di home secretary dey expected to announce her final decision for inside statement to MPs for di House of Commons.

Indefinite leave to remain (ILR), wey also dey known as settlement, dey give pesin di right to live, work and study for di UK for as long as dem like.

Dem also fit apply for benefits if dem dey eligible. Dem fit also use am to apply for British citizenship.

Mahmood bin announce plans to delay settlements in response to concerns on top di number of pipo wey go soon reach eligibility, for di wake of record post-Brexit net migration figures under di previous Conservative govment.

Di Home Office tok say dia figures show net migration - di difference between dos wey dey enta and leave di kontri - 2.6m pipo add to di UK population between 2021 and 2024.

Di department dey forecast say around 1.6m pipo fit therefore settle between 2026 and 2030.

Dem submit more dan 200,000 responses to di consultation on Mahmood proposals, wey dem launch under former Prime Minister Sir Keir Starmer.

Several Labour MPs bin raise concerns about di impact of di proposals on migrants wey already dey live there, as dem describe di retrospective approach as "un-British".

Dem also warn say e fit make UK skills shortage worse, especially for di care sector.

Mahmood bin argue say di reforms dey important to avoid a "drain on our public finances".

For her foreword to di consultation, Mahmood tok say di bar to enta di UK don "reduce well-well" and dis dey most evident for di health and care visa".

She write: "One attempt to fill between 6,000 and 40,000 jobs see di arrival of 616,000 individuals from 2022 to 2024.

"Ova half no even dey land di kontri to work for dat sector but instead na dia dependants dey do am."

Home Office calculations bin suggest say 196,000 care workers plus dia adult dependants fit settle between 2026 and 2030, for inside one estimated lifetime cost of £9.5bn to taxpayers.

On Monday, di Institute for Public Policy Research (IPPR) think tank tok say skilled workers and dia dependants due to settle for UK under current rules dey expected to make net lifetime contribution of around £115bn through di taxes dem dey pay.

Prime Minister Andy Burnham last week tok say settlement na "right to be earned, no be sometin dem dey give pipo automatically".

Di Home Office no go tok pim on Mahmood final decisions till dem carry am go meet parliament.

For September, Conservative tok-tok pesin say, "Shabana Mahmood don bend for pressure of Angela Rayner and ger open borders MPs and go tear her own plans to reform idefinite leave to remain".

Di pesin add say, "dis na slap to di face of British taxpayers wey go need subsidise low-skilled, low wafe migrants."

Permanent residence, or indefinite leave to remain, na wetin dey give pesin right ot live, work and study for di UK as long as dem want. Dem also fit apply ofr benefits wey dem qualify for.