Crypto giant Binance confam $6.3bn hack suspected to be di largest in history

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Osmond Chia
- Role, Business reporter
- Published
- Read am in 4 mins
Cryptocurrency giant Binance on Thursday say $6.3bn (£4.7bn) worth of digital assets don dey affected by di biggest crypto hack wey don eva happun in history.
Di world biggest crypto exchange say about half of di assets don freeze, but many still dey di hands of di hackers, and dem go "cova all losses".
Early checks show say di incident fit involve one engineer laptop wey dem tok say don dey compromised, wey allow di attacker to make unauthorised withdrawals, Binance tok.
Two analytics firms don attribute di incident, wey don pass di record-setting $1.5bn hack on di Bybit exchange for 2025, to one North Korean hacking unit wey dem dey call TraderTraitor.
Cyber-security firm Check Point say dem sabi di unit in di industry as Lazarus Group, wey dem bin blame for di 2025 hack.
Check Point chief information security officer Jayant Dave tok say di estimated losses wey Binance make na "di biggest crypto theft wey dem don record".
AI-powered investigations company TRM Labs say for dia report several elements of di Binance attack resemble early North Korea-linked incidents, including di Bybit hack.
Di lab global head of policy Ari Redbord tell BBC say di Binance hack na "watershed moment" e neva reach wetin di industry don see bifor.
Di attacker still hold big amount of di stolen assets, efforts to trace and recova di funds still dey far from ending, Redbord add.
Dem establish Binance for China for 2017 - e dey allow users trade digital assets, and dem get more dan 300 million registered users all ova di world.
Di company for 2024 say dem get more dan $160bn for assets under dia custody.
Di exchange don dey face regulatory scrutiny around di world.
Chainalysis, one crypto analytics firm, also tok say dem get "high confidence" say di North Korea group dey linked to di hack.
In di last few years, North Korea-linked operatives dey focus on attacking crypto companies for big thefts of digital tokens.
Western security agencies say dem don use di stolen funds to finance North Korea nuclear weapons and missile development programs.
Di regime don deny any involvement in di hacks in di past.
Eric Jardine, Chainalysis Head of Research, urge evri exchange make dem remain vigilant becos di platforms na attractive targets for hackers becos of di sheer value of di assets.
Binance no respond directly to BBC questions about di incident potential links to North Korea, but dem say: "We dey work closely wit our law enforcement partners to confam di identity of dis criminals and bring dem to justice."
Di incident concern Binance.com - but di smaller crypto platform Binance.US, wey dey provide trading services for American residents, say dia platform no dey affected by di issue.

Wia dis foto come from, Bloomberg via Getty Images
Binance co-CEO Richard Teng say di company first investigation show say di hack start wit one engineer laptop wey don dey compromised.
"Dat give di attacker access to one service container, wia dem submit unauthorized withdrawal transactions," e tok for one statement.
"To make am clear: di attacker no just use one engineer permissions, and dis no be one 'one-click' action. Dem use more complex attack process. Our investigation never attribute responsibility to any individual. So far, we no see any evidence of any wallet private key leak."
E tok say dem go share detailed "post-mortem" once dem complete di investigation.
Check Point's Dave say dis attack also resemble di hack wey happun for crypto exchange Bitget for September, wia dem lose $388m (£289m): "Dis mean say attackers no longer need di vault keys. Dem dey target di systems and pipo wey get authority to use dem."
In a series of posts, Yi He, Binance co-chief executive, tank various crypto issuers say dem freeze di assets.
"Safety first: withdrawals dey currently disabled now until di environment confamd to dey secure," she tok.
Two oda big crypto platforms, Tether and Circle, say dem freeze total of about $2.4bn assets in response to di potential Binance hack.
World Liberty Financial, crypto company wey dey linked to US President Donald Trump and im family, say dem don work wit dia partners to freeze stolen funds.
Crypto exchange Coinbase say dis incident no affect dem and dem dey monitor di situation.
Several crypto industry observers don flag concern about potential hack on Binance hours bifor di exchange confam di security issue.
Bitcoin drop more dan 4% afta di alerts. Di price of oda major cryptocurrencies including Ethereum and Solana also fall sharply.



















