Federal govment launch 50,000 naira monthly cash relief for vulnerable Nigerians - who go benefit and how?

Wia dis foto come from, PiusUtomi Ekpe via getty images
Nigeria Govment don start one monthly cash relief programme wey go help reduce di impact of di rising cost of living.
For di relief programme govment say dem go give each household N50,000 about ($37.14) evri month.
Di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Reduction, Bernard Doro make di announcement on Friday for statement wey e release for Abuja, Nigeria capital.
Im tok say di National Emergency Relief and Stabilisation Intervention (NERSI) na presidential initiative wey dey designed to provide immediate financial assistance to millions of vulnerable Nigerians.
According to am, dem introduce di intervention programme to respond to di rising cost of food and oda essential goods.
Dis rising costs around di world dey continue to put pressure on Nigerian households.
Who go benefit from dis programme and how govment go contact dem?
You be Nigerian no mean say na evribody or evri household go benefit from di programme to collect free ₦50,000 evri month. You need to dey vulnerable first.
Oga Boro tok about di pipo wey go benefit from dis programme.
"Under dis intervention, di pipo wey go qualify to benefit go receive ₦50,000 ($37.14) monthly, wey go provide direct assistance to help meet essential needs and reduce di burden of living costs," im tok for statement.
According to di minister dem go dey review di programme evritime so dat dem go fit respond to di changes for di cost of living.
Im add say dem go notify di pipo wey dey benefit from di programme directly bifor dem go make any adjustment.
Di Humanitarian Affairs and Poverty Reduction minister add say dem dey work wit licensed digital financial service providers.
Dis na to make sure say di programme dey secure, fast without delay and di delivery of di money to di beneficaries go dey transparent.
Na text messages di beneficiaries go receive from di providers.
Dis text message go ask for dia consent bifor di providers go pay di money directly into dia bank accounts or mobile wallets.
Di minister explain say di beneficiaries no need to apply, pay any fee, or register through any agents to access di di programme.
How safe dis tin be from mago-mago pipo?
Oga Doro draw ear for Nigerians make dem shine dia eyes well-well against mago-mago pipo.
E advise evribody wey go benefit from diintervention programme make dem no give ot tell anybodi dia personal identification numbers (PINs) or Bank Verification Numbers (BVNs).
"If you no dey sure about any message, or anybodi ask you for money, call di official NERSI helpline on 0700-022-2222," im tok
Di minister say NERSI dey add to di federal govment social protection and economic support programmes wey dey exist as dem go dey support household resilience and economic stability.
Im add say di intervention dey in line wit President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda.
E also show dia committment to deliver di programme wit dignity, transparency and accountability.
Dis na di third intervention ptogramme wey nigeria govment dey do within one month sake of di cost of living.
For October Nigeria govment bin do discount for fuel for 90 days but na for only di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) retail station e go fit happun.
Few days ago, Nigeria govement offer ₦70,000 transportation allowance to workers wey make di Nigeria Labour Congress and di Trade Union Congress put leg for one trouser.
TUC sday dem no go accept di offer make govment instead increase salary but NLC say tuc no get di power to reject wetin dem no be part of.
Now di latest dey come from di humanitarian and poverty reductiom ministry, which one gho be next?



















