Who be victims of deadly Florida jet crash?

Wia dis foto come from, Anthony Robinson/Facebook
Nine pipo don die afta one small jet crash and explode for Florida on Sunday.
Di Learjet 60 bin dey go Bahamas from Austin wen e nosevide into one multi-lane highway.
Di National Transportation Safety Board dey investigate weda ice and turbulence contribute to di crash, and weda human error also play a role.
Hia na wetin we know so far about di victims.
Adam Robinson and Helen Sharp
Di Texas tech entrepreneur, im wife Helen Sharp and dia two children, Emma, 4, and Charlie, 2, die for di plane crash, according to one joint statement from some of di families of dos wey kpai.
Dia family describe dem as "devoted parents" and dem tok say dia children be "di light of dia lives".
"Helen and Adam be di love affair wey go last forever. Dia warmth, generosity and gift for making pipo feel welcome bin touch so many lives," di statement read.
On im LinkedIn page, Robinson describe imsef as di founder and CEO of RB2B and Retention.com, plus di CEO of Moltsets.
End of Di one wey oda users dey read well well
Bifor dat, e work for global financial services business Lehman Brothers and di banking group Barclays.
Di BBC don contact di companies for statement.
Fellow tech entrepreneur Jesse Ouellette post for LinkedIn about Robinson death, tok say Robinson help am wen e dey build im company.
"E bicom my friend and person wey I see eye to eye wit on how to build software companies," Ouellette write.
"E fit disagree wit you about almost anyting, and somehow you go still leave liking am even more."
Robinson last post for di networking site na on Sunday, about one debate wey im and Ouellette schedule for di following week.
Meanwhile, according to media reports, Helen Sharp na artist.
Im papa, Dudley Sharp, tell Florida news site The Palm Beach Post say di news say im family dey onboard di plane na "quite a blow".
"We get one daughter, im husband and two grandchildren for di plane," e tok.
Rachel Reed, Charmi Fehr and Anita Maria Cetina
Reed, Fehr and Cetina also dey travel aboard di jet wit Robinson, Sharp and dia children.
For di joint family statement, dem describe Reed and Fehr as pipo wey "full of joy and adventure".
"Dem love dia pipo, fully and witout hesitation. From di moment dem meet, dem put evritin into each oda and di life wey dem dey build," di statement add.
E no immediately clear wetin dia relationship be wit Robinson and Sharp.
Di statement say Cetina "care for Emma and Charlie wit tenderness and devotion, and she truly be part of di family".
E add: "She show us one legacy of unconditional love and devotion."
Jeff Gregory
According to East Coast Jets, one private charter company wia Gregory don work bifor, Gregory, 55, don be identified as di pilot of di plane.
"We deeply sad to learn say Captain Jeff Gregory dey among dos wey lose dia lives for yesterday tragic aviation accident for Palm Beach," one spokesperson for di company tok for statement on Monday.
Di spokesperson say Jeff work for East Coast Jets "briefly" for 2016 and 2017.
Nathalia Filgueiras

Wia dis foto come from, Nathalia Filgueiras/Thread
US media don identify Nathalia Filgueiras, 20, as di copilot of di plane. She earn her pilot licence when she be 17 years old.
Filgueiras mama, Camila Corteleti, confirm to US media say im daughter die for di fireball.
Corteleti tell di New York Times: "She love di freedom. E be completely different to see di world from di top."
For one 2023 interview wit one local news affiliate of CBS News, Filgueiras talk proudly about receiving her pilot licence while she still dey senior for high school.
"I like to dey different dan evrione," she tok. "Some pipo tink say e dey weird say I fit fly planes, but I no fit drive motor, I mean I fit, but plenty pipo tink say e funny."




















