'Anambra na di safest state for Nigeria' - Soludo

Anambra state govnor Chukwuma Soludo
Published
Read am in 4 mins

Di govnor of Anambra state Chukwuma Soludo don hail di southeast state as di safest for Nigeria.

Soludo for one interview wit BBC, tok say kidnapping, wey be one major security challenge for Nigeria no dey im state again as kidnappers and jaguda pipo wey dey cause trouble for di state don run comot.

Di former Central Bank of Nigeria (CBN) govnor also say di pipo of di state dey cool headed and no dey find trouble.

"We dey claim say Anambra na di safest state for Nigeria or at least one of di safest state for Nigeria today. In terms of law and order I go tok say Anambra dey calm, Anambra dey safe, we claim to be di safest but to be modest we be one of di safest today."

For di interview, di Anambra state govnor also tok on di ongoing kwanta between im and di former govnor of di state, Peter Obi, wey also be di presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC).

Soludo say im and Obi na friends wey also be like brodas for family, despite dia political differences and ongoing kwanta. E stress am say im differences wit di NDC candidate dey completely political.

"Peter Obi and me na friends we be like family di difference between us be say im get im own idea about who im want to be di govnor of Anambra. I don contest two times now to be govnor of Anambra and im don oppose me two times. Im get im own candidates for di same two elections.

"Im wife na my pikin baptismal godmother while my wife na im pikin confirmation godmother," e tok.

"Wen we tok of our political differences, evryone get dia interests. Na politics we dey do," e add.

Di two of dem disagreements na ova di state finances and dia political differences. Dem get different views concerning politics and di presidency.

For di presidency of Nigeria, Soludo say im bin tell di former Anambra State govnor, Peter Obi to contest under di all Progressives Grand Alliance(APGA) wey be one of di biggest political party for di state but Peter Obi bin no gree as im go contest under di Peoples democratic Party and later e port go join Labour Party.

"For March, 2022 I bin propose to am make im run under APGA (All Progressives Grand Alliance) but im bin no gree. No be say im go win di presidency but na for us to organise di Southeast to dey beta. We bin debate but finally im go run under PDP (Peoples Democratic Party) and to Labour Party, I bin know say e no go go anywia."

Di govnor also tok about di airport wey im administration dey build for Anambra State, e say e go dey for di centre of di Southeast.

Di former CBN govnor tok say di airport dey important sake of di political and economic boundaries for di region.

Di politician say even though di state bin don already get di Chinua Achebe airport wey no dey function to capacity, dis one na "aeropolis"

"Anambra na political boundary, no be so? Di airport wey we dey build na di airport of today and tomorrow. E go be di airport wey go dey for di heart, di centre of di southeast."

On im biggest challenge, Soludo say challenges na part of di work wey im bin apply for, and im know di challenge, im know di area and im also know wetin di issues be. However im still get clear vision to lay beta foundation for di state for di next 50 to 100 years.

"I get clear vision about di part wey we suppose go, I no dey even call dem challenges, I say no excuse no complain.

"We come in and dis na di first administration wit longterm vision on wia Anambra go be, for di next 50 and 100 years to come.

" I carry plan come our 50 year development plan and dis na di foundational administration, wey go lay di foundations toward Anambra vision 2070."