"I want justice for my son" - mother of Ghanaian boy Javits Frimpong wey dem shoot for US

Boy on green jacket and mama on black jacket
Published
Read am in 4 mins

Di mother of di 15-year-old Ghanaian boy Javits Frimpong wey dem kill for di US don comot Ghana for America afta dem grant her emergency visa by President Trump.

Doris Adu Gyamfi speak to di BBC for di airport bifor her departure, say she want justice for her son, wey wan become medical doctor.

Dis na afta President Donald Trump bin agree to grant visa to di mother of Javits Frimpong, wey dem kill for Bronx, US.

Di visa na for di mother to mourn her son in pesin, according to to di call between New York Mayor Zohran Mamdani and President Trump.

'I wan go bury my son' - Javits mama

Dem shoot and kpai Thomas Frimpong 15-year-old son wen e bin dey go school on Thursday, 29 October 2026.

Police officers bin rush am to St Barnabas Hospital, wia e later kpai from im injuries.

Now, di mama dey on hee way to di US to bury her pikin.

'' I wan justice for my son,'' she say.

Di mama say she want justice for her son, wey police still dey find who di suspects wey carry out di shooting.

Members of her family and Dr Erieka Bennett, Head of Mission of di African Diaspora Forum (AU), bin follow her go airport.

''I go to America to plan my son funeral,'' she add.

She also tank di govment and well-wishers for dia support and prayers sake of her her son death.

Di death of Javits don spark outrage for Ghana and di US, and begin debate about gun violence for America.

Ghana govment don condemn di killing and say e dey follow di case closely to ensure justice.

Ghana also ask US authorities to conduct thorough investigation and say e dey ready to provide legal and consular support to ensure di perpetrators dey brought to justice.

Anoda Ghanaian found dead in US

Days afta tori of fatal shooting of 15-year-old Ghanaian schoolboy for Bronx, di Ghanaian community for di US don dey mourn anoda death.

Family of Joseph Owusu bin confam im death for statement on Tuesday, afta tori spread say dem find di body of di 24-year-old for one dumpsite for di Bronx, about two weeks afta dem declare am missing.

"All of us dey devastated and heartbroken by di loss of our dear brother, son and friend." Victoria Owusu wey be sister of di deceased tok for one Instagram post.

BBC News Pigin neva fit confam di circumstances wey surround im death.

Di sister say police don dey investigate di mata as she caution against fake news.

She also tok say as at now nobody really no wetin happun or how e take kpai.

"We dey beg blogs and social media pages say make dem no spread misinformation about di death out of respect for di family and sake of di sensitivity of di case, any misinformation fit affect di integrity of di investigation, at dis time nobody sabi wetin happun," she tok.

Joseph be instrumentalist for one church
Wetin we call dis foto, Sister of di 24-year-old confam di death and also want make pipo no spread misinformation about di mata
law enforcement are yet to issue any formal update
Wetin we call dis foto, Di death of Joseph Owusu dey come days afta di fatal shooting of 15-year-old Ghanaian Javitz Frimpong for di same Bronx

Di family don set up GoFundMe to ask for support to as dem say di donation go reduce di burden of funeral arrangement, burial expenses and oda tins di family dey face for dis devastating time.

One Ghanaian actor and comedian wey base for di US, Emil Wood wey dey popular as 'Nana Tonardo' don share memories wit di late Joseph Owusu on top im Instagram page.

Nana Tonardo write "Joseph why, who don kpai you like dis?"

"We suppose meet for thanksgiving bifor, I tink say you ask me to bring you to Africa, who do dis to you? Rest in peace my Joseph."

Pipo wey sabi di 24-year-old dey mourn am including some of im church members for di Bronx.

Di Ghanaian community for New York dey demand justice.

Ghanaian authorities and New York law enforcement neva comment on dis mata.