How beneficiaries go receive Nigeria govment 50,000 naira cash relief

One customer dey hand ova bundles of 1000 Naira banknotes to anoda trader inside one market in Lagos
Published
Read am in 4 mins

Eligible Nigerians now fit receive N50,000 in financial support under di Federal Government National Emergency Relief and Stabilisation Intervention (NERSI) programme.

Nigeria govment tok say dem go pay di N50,000 straight to di account of di beneficiaries.

Di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation wey announce di informate, tok say dem go send di money directly to pipo through mobile wallet, as dem make am clear say no middle man.

Di minister of humanitarian affairs and poverty alleviation Bernard Doro explain say di NERSI grant scheme na presidential initiative wey dem design to provide immediate financial assistance to millions of vulnerable Nigerians.

According to am, dem launch di programme to reduce di impact of rising cost of food items and oda essential commodities.

Rising global commodity prices still dey put pressure on Nigerians.

Who go benefit and how govment go reach dem?

Oga Doro explain say dis govment intervention no be evri Nigerians as criteria dey to bicom beneficiary.

"Under dis scheme, eligible beneficiaries go receive N50,000 evri month, wey go provide direct assistance to meet daily needs and reduce di burden of di cost of living," e tok for di statement.

Di beneficiaries of di cash relief must dey poor and come from vulnerable Nigerian households.

On how dem take select di beneficiaries, di ministry say na from verified national identity records and di national social register, dem screen di record to reach poor and vulnerable households.

According to di minister, dem go review di plan from time to time in order to take appropriate measures to reduce di cost of living burden on citizens.

E add say beneficiaries of di programme go receive direct notification before any changes are made.

Di minister also say dem dey work wit licensed financial institutions.

E say dem do am to make sure say di programme run safely, quickly and witout delay, and say di money reach dos wey deserve am honestly.

Beneficiaries go receive text messages from di companies.

Di message go ask for dia approval bifor dem transfer di money directly into dia bank account or mobile wallet.

Di minister explain say beneficiaries no need to apply for di programme, pay any fee, or register through any agent bifor dem fit benefit from di programme.

How to protect your sef from scammers?

Doro warn Nigerians make dem shine dia eyes against fraudsters.

E advise anybodi wey go benefit from di scheme make e no give or disclose im Personal Identification Number (PIN) or BVN number to anybodi.

"If you no sure about any message, or if somebodi ask you for money, call di official NERSI helpline on 0700-022-2222," e tok.

Di minister say NERSI na part of di federal govment existing social support programmes, and say e go help strengthen economic equality.

E add say di plan align wit President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda.

E also show govment commitment to implement di plan wit integrity, honesty and fairness.

Dis na di third time di Nigerian govment go announce relief package within one month bicos of di cost of living crisis.

For October, di Nigerian govment bin introduce 30-day fuel discount, but pipo fit only get di discount for NNPCL filling stations.

Few days ago, govment also announce say dem go provide N70,000 transport allowance for workers, one move wey don cause disagreement between di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC).

Di TUC say dem no go accept di offer, say govment for better increase wages, but di NLC say di TUC get no authority to reject sometin wey e no be party to.