Peter Obi, Benue govment drag over visit of NDC Presidential candidate

Officer cover im face wit mask, Peter Obi dey wear black cloth, e stretch im hand

Wia dis foto come from, Peter Obi/X

Published
Read am in 5 mins

Di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress (NDC) Peter Obi don shout come out say dem no allow am enta communities wey e wan enta for Benue state.

Oga Obi say some youths and security pipo bin come out to chase am and im team comot say dem no wan see am for di state.

Obi enta Makurdi, Benue capital so e go fit reach some communities wey don dey affected by violence and attacks, but dem block am.

E come add say di pipo wey block am also attack im convoy on Tuesday wen e dey try connect to oda communities for di state.

Obi say di reason why e go Benue na to visit places wey jaguda pipo don attac in recent times.

"E dey ridiculous, we arrive Benue dis morning. For our way to Yelwata commnunity to condole wit di pipo wey affected by attacks, I feel say make I go reach dis pipo as we start our campaign, to show respect and support di pipo."

"Only to arrive Makurdi dis morning, and some thugs block me saying 'peter Obi go back", I come dey wonder say na Nigeria I still dey," Obi tok.

According to Obi, e say make security pipo no look away from dis threat, make dem call di jaguda pipo to order.

"As presidential candiate, I wan visit evri communities and meet wit pipo, na why I dey here today. We no wan cause confusin or endanger pipo life, na why I dey civil. I dey call on security pipo to chook eyes into dis matter, and call state govnors to orders."

"E dey deeply distressing to witness such hostility. I come to Benue not for partisan politics, but to mourn wit our pipo, to listen to families wey don lose loved ones, and to offer comfort for dis moment of sorrow."

Also di vice presidential candidate wey be Obi running-mate, Rabiu Kwakwanso tok say di attack on im oga for Benue na 'dark day for our democracy.'

Kwakwanso wey post for im X on Tuesday afternoon tok say evri citizen of Nigeria get right to to move greely for di kontri

"Authorities must rememba say di Constitution guarantee evri citizen di right to freedom of movement. Dis right apply even more strongly to Mr Obi wey be former govnor and leading opposition figure," kwakwanso tok.

E add say make Benue State Govnment find soe wey dey behind di attack and make dem prosecute dem and ensure say di NDC candidate and im convoy fit move freely for di state.

On di oda hand, di Obidient Movement through dia statement condemn di attack and blocking of Obi from moving freely wthin Benue state.

Dem say di alleged thugs "barricade Gboko Road near di Makurdi airport, bringing traffic to standstill for dia effort to stop Obi movement and prevent am from going on wit im engagements across di state."

'Obi no write letter to us'

Meanwhile, di Benue State Commissioner for Information, Solomon Iorpev, tell local media pipo say di visit of Obi to di state suppose dey according to protocol.

Di commissioner wey react to di plenti tok tok about di blocking of Obi from moving within di state, tok say dem no know dose wey dey behind di blocking, but Obi suppose notify di State govment about im visit.

E say based on who Peter Obi be, e no fit dey waka for di state anyhow witout protocol.

E say Obi na high-profile pesin as per say im be former govnor and presidential candidate, and na di state suppose provide security for am.

"High-profile pesin wey be former govnor of a state dey come into di state; e suppose write letter to di State Govment.

"Na we suppose guarantee im safety and protection, but for situation wey dem no write any letter, we no fit guarantee im, safety," di commissioner tok.

Meanwhile, di commissioner say di time wey Peter Obi come Benue state na di same time wey all di youths from di 23 local govments dey meet- so dem no sabi dose wey dey behind id attack.

Di Benue State Govment say dem reject di claims by di candidate of di NDC, Peter Obi say thugs wey dey work for di state govment block and attack am wen e come di state.

According to Tersoo Kula wey be di Chief Press Secretary to di Govnor, tok through statement on behalf of di state govment say di attack fit be political matter within NDC.

E say Benue state govnor no sabi wetin Obi dey tok about.

"Di allegations dey unfounded and desperate attempt to drag Governor Hyacinth Alia and di Benue pipo into wetin fit be internal political matter within di Nigeria Democratic Congress (NDC)."

"Based on im antecedents of making untrue statements against di state, we get evri reason to doubt weda e visit Makurdi, di state capital today."

Di govment tok say Peter Obi no be threat to di govnor say even if e visit di state, di security agencies go handle di issue.