Who be di 28 governorship candidates of opposition ADC for 2027 elections

Foto of di National Chairman of di African Democratic Congress (ADC), Senator David Mark, as e bin ginger govnorship candidates of di party to avoid hate speech and empty promises as dem start dia campaign ahead of di 2027 general election.

Wia dis foto come from, ADC/X

Wetin we call dis foto, Foto of di National Chairman of di African Democratic Congress (ADC), Senator David Mark, as e bin ginger govnorship candidates of di party to avoid hate speech and empty promises as dem start dia campaign ahead of di 2027 general election.
Published
Read am in 4 mins

Former Labour Party govnorship candidate for di 2023 election, Gbadebo Rhodes Vivour and former Attorney General of Nigeria, Abubakar Malami names dey for di list of govnorship candidates wey di African Democratic Congress (ADC) release.

Di opposition party for Nigeria publish di names of di pipo wey dey contest for govnorship position and dia deputy for di 2027 general elections for 28 states.

Dis one mean

Anoda popular name for dis list na Great Ogboru of Delta State wey don dey contest to be govnor since year 2000. Im bin constest against former Delta State govnor James Ibori.

Since year 2000, Ogboru don join different political parties back to backl but im neva emerge as winner.

For post wey di National Publicity Secretary of di political party, Mallam Bolaji Abdullahi sign for dia official page, dem tok say dem bring out dis list " to offer Nigerians credible leadership and real alternative."

Di Action Democratic Congress dey face serious internal gbege sake of di kasala wey dey happun for some states wey get factions.

Even though dem bin dey try to solve di mata, e drag sotay di two factions land for court and court still dey do back and front for di mata.

Full list of ADC govnorship candidates and dia states

Abia State

Kalu Kalu Agu

Alozie Ogadinma Darlington

Adamawa State

Modibbo Hamman Tukur Ribadu

Aguwa Kevin Iliya

Akwa Ibom State

Akpanudoedehe John James

Nsien Mkpombik Tommy

Bauchi State

Sen. Haliru Dauda Jika

Sama'lia Mohammed Kabir

Benue State

Rt.Hon Herman Iorwase Hembe

Abba John Abba

Borno State

Babagana Buhari

Mamman Dauda

Cross River State

Nkoyo Toyo

Okwoche Andrew Adagbor

Delta State

Great Ogboru

Afiari Gloria

Ebonyi State

Ukpai Mbah Ude

Onwe Daniel Ede

Enugu State

Ochi Oboozeze Chukwuma

Eze Anrze Christopher

Gombe State

Bala Bello

Bala Sani Sisa

Jigawa State

Sabo Mohammed Nakudu

Musa Yau Balarabe

Kaduna State

Isa Mohammed Asiru

Kantiok Rmiya Ishaku

Kano State

Ibrahim Ali Amin

Shehu Abdulkadri Bari

Katsina State

Sen, Ahmad Babba Kaita

Aminu Yar Adua Ahmed

Kebbi State

Abubakar Malami

Zagi Musa Mohammed

Kwara State

Zakari Mohammed

Olawuyi Julius Olayide

Lagos State

Gbadebo Rhodes Vivour

Gbadamosi Babatunde Olalere

Nasarawa State

Nuhu Angbazo

Ahmed Yusuf

Niger State

DR. Mohammed Kpautagi

Musa Mamman

Ogun State

Biodun Collins Ogundipe

Muraina Oluwaranti Oluyemi

Oyo State

Taofeek Adegboyega Adegoke

Wahab Adeniyi

Plateau State

Brig.Gen John Sunday Sura

Pwajok-Kele Chundung Bitrus

Rivers State

Gabriel Pidomson

Okumgba David Amapakaye

Sokoto State

Manir Mohammad MOHAMMAD Daniya

Isah Bello Ambarura

Taraba State

Abubakar Umar Tutare

Kwetishe Haruna Kwenyan

Yobe State

Kassim G. Gaidam

Kori Lawan Mohammed

Zamfara State

Shinkafi Bilyaminun Yusuf

Muhammad Abdulmuddalib Auwal

Why 28 states inside of 36 and di FCT?

Di African Democratic Congress publish di names and deputy govnorship candidates sake of say na di ones wey go run for di 2027 elections.

Oda states don do dia own elections and doz states na di states wey dey do off-cycle election for Nigeria.

Di off-cycle election states na Osun State wey just do dia own last month, 15 August wey Ademola Adeleke of Accord Party win and ADC candidate na Najeem Salaam.

Bayelsa , Anambra, Imo, Ondo, Edo, Ekiti and Kogi na oda states wey dey do off- cycle elections.