Shark kpai 65-year-old swimmer for South Africa east coast

Wia dis foto come from, Lochrenberg family
One South African woman kpai afta shark attack her near di country east coast - na di first time dem dey record dis kain death dis year.
Janine Lochrenberg bin dey swim near di beach for KuGompo City (formerly East London) on Tuesday morning wen di shark attack her.
Witnesses say di shark bite di 65-year-old for two places and she die bifor dem carry her comot from di water.
According to di Florida Museum International Shark Attack File, Shark attacks dey hardly happun for South Africa, na about ten don kpai pipo since 2012.
Lochrenberg bin comot for morning to go do her daily morning swim wit her local open water swimming club wen doi shark attack her around 08:00 (06:00 GMT).
Na oda swimmers carry her comot from di water, but dem beliv say she die bifor dem fit bring her out from di water.
Di shark bite her for thigh and her upper arm, na wetin one of her fellow swimmers tell di BBC.
Dem also say she bin dey wear di magnetic band for her ankle wey suppose to pursue sharks from her dat time.
Lochrenberg sister Margot say she bin dey hold her sister head as dem carry her out from di water but beliv say she bleed well-well for di water.
She tell di BBC say her sister bin "love water well-well even though she know say high shark presence dey for East London".
"She bin make peace wit am. She get deep connection wit water and na remarkable pesin," she tok.
Barbara Briceland, Lochrenberg partner, tell di BBC say di retired medical physicist na good swimmer, wey dey swim far out into di breakers, e describe her as veri brave.
"She bin dey highly intelligent, plenti of fun, kind, in quiet way, thoughtful, well-loved wit love of life."
Briceland add say dem bin dey look forward to retirement and how to leave go for one three-week road trip togeda.
Authorities confam say dem don close Orient Beach wia di attack hapun and anoda beach wey dey nearby.



















