'Migrants no suppose be scapegoats for unemployment or crime for South Africa' - Ramaphosa react to anti-migrants violence

Nigerian President Bola Ahmed Tinubu (L) shake hands wit South African President Cyril Ramaphosa (R)

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian President Bola Ahmed Tinubu (L) bin meet wit South African President Cyril Ramaphosa (R) for di 11th session of di South Africa-Nigeria Bi-National Commission (BNC) for Cape Town, South Africa on December 3, 2024.
Published
Read am in 5 mins

South Africa President Cyril Ramaphosa don react again to di rising anti-migrants violence for di kontri as e clear say nobody get di right migrants scapegoats for unemployment, crime or shortcomings for di delivery of public services.

Ramaphosa bin take firm stand against attacks on foreign nationals for South Africa during di Ordinary Session of di 7th Legislature of di Pan-African Parliament wey hold on Monday, 27 July for Gallagher Estate, Midrand.

Im address dey come afta informate say one Nigerian national, Ibeh Chika Simon kpai for South African police hand during one police service operation for Cape Town on 23 July.

Di protesters wey don begin dia marches since April, dey blame undocumented migrants from Africa for crime, unemployment and pressure on public services, and these protests don lead to violence, havoc, theft and even deaths.

However, during di session, President Ramaphosa admit say foreign nationals for South Africa don bicom target of violence, intimidation and attacks sake of di anti-migrant sentiments.

E however make case for di protesters say for some of dem, na genuine concern about di social and economic burden of illegal migration dey ginger am.

On di steps South Africa dey take to handle di issue of migration wey don make di rainbow dey di eye of di storm recently, Ramaphosa say im govment first don take firm position against any form of intimidation, vigilantism or violence directed at foreign nationals.

"We don also take steps to strengthen and enforce our laws, to diffuse tension and to ensure evribody within dia borders respect di rights of all.

Africa must join hand togeda to tackle migration - Ramaphosa

South Africa President Cyril Ramaphosa

Wia dis foto come from, Getty Images

Di South Africa leader say to address migration na combined effort and no be di work of just one kontri, but for all African kontris to join hands togeda to manage migration.

E say wetin happun for di southern African kontri suppose don open di eye of all di countries for di continent to see "how unmanaged migration fit undermine di sovereignty, security and social order of countries."

E say di continent response must dey united, firm, fair and effective immigration management wit solid defence of human dignity plus di rule of law.

"Our task na to ensure say we manage migration for manner wey affirm di rights and dignity of all pipo, wey respect international conventions and wey advance social cohesion."

'Dis gatz stop' - Nigeria to South Africa

Meanwhile for Nigeria, di govment dey para as dem ask South Africa govment to put an end to di frequent attacks and killings of dia citizens for di rainbow kontri.

Nigeria Minister of State for Foreign Affairs, Sola Enikanolaiye, express Nigeria govment position during one meeting wit di South African Minister of International Relations, Ronald Lamola.

Enikanolaiye say di Nigeria govment don notice pattern for di attacks against dia citizens wey don "raise di issue of state responsibility" and "complicity", as most times, pipo dey see as South African police go just stand dey look as angry mobs attack Nigerians and dia businesses.

"We get records of Nigerians wey get legitimate papers to remain for South Africa, yet dem dey attacked," e tok.

"E dey on record say from 2022 alone, 98 Nigerians don die for mob actions, for hate-related actions, wey we don call Afrophobia. Becos we discover say most of di victims of these ugly situations na Africans and Nigerians in particular...of which we want make e stop."

Enikanolaiye say migration na fact of history, wey arise from push and pull factors, and e suppose dey properly managed.

"If there are criminals, as you tink say dem be, we dey repeat am say di solution no be to kill dem. If pesin na 'criminal for drug trafficking' rules and regulations dey. Arrest dem, prosecute and jail dem. Di Nigerian govment no go support drug peddlers," di minister tok.

Earlier for di meeting, Minister Lamola maintain say President Cyril Ramaphosa don always dey open against any intolerance wey include xenophobia, violence or discrimination wey dey target anyone within di South African border.

E also outline three specific areas of concern wey don heighten di heightened recent tensions between di two countries:

  • First na di purported installation of one unrecognised traditional ruler, "Igbo King", for di Eastern Cape Province for March 2026. Dis mata bin cause widespread public concern across South Africa.Minister Lamola say e happun wen South Africa dey actively chook eye into di constitutional role of traditional leadership in a post-apartheid society.
  • Second, na di involvement of certain foreign nationals, wey include Nigerian citizens, for organised crime, illicit drug trafficking, and financial fraud. E say as of 7 July 2026, dem don process more dan 500 Nigerian nationals for various offenses.
  • Anoda reason wey lead to di high tension na say some foreigners dey highjack residential and commercial properties for urban centers like Hillbrow (Johannesburg) and Sunnyside (Pretoria). Also, law enforcement officers dey face violent resistance or obstruction during criminal investigations from foreign national, Lamola add.

South Africa foreign affairs minister say these incidents don fuel negative perceptions surrounding Nigerian nationals wey dey live for South Africa ova di years.

Di Nigerian govment say dem don evacuate almost 1,500 of dia citizens from South Africa since di recent resurgence of anti-immigration protests for di kontri, and say dem go push for compensations for all di pipo wey don suffer any kind of loss as a result of di unrests.

On di way forward, di two govments agree say bilateral diplomacy and Pan-African solidarity remain di essential frameworks to ensure peaceful coexistence, safeguard human rights, and deepen historical ties between South Africa and Nigeria.

Many African countries wey include Gnana, Nigeria, Malawi, Zimbabwe, among odas begin evacuate dia nationals from South Africa as di tension against undocumented foreigners continue to rise.

Nigeria say dem don evacuate ova 1500 citizens and Ghanaian govment say nearly 2,000 of dia nationals don commot South Africa sake of di tension.