South African court stop process to impeach President Ramaphosa

Wia dis foto come from, FRENNIE SHIVAMBU/GALLO IMAGES VIA GETTY IMAGES)
South Africa president Cyril Ramaphosa on Friday win court challenge wey him initiate to stop parliamentary impeachment process ontop allegations of misconduct wey dem level against am.
Western Cape High Court deliver judgement wey grant di President interim interdict wey go temporarily stop di parliamentary impeachment process from moving forward.
Di ruling go boost Ramaphosa chances as him go await di outcome of anoda separate court case wey dey challenge one independent panel report on a case of stealing wey happen for the president Phala Phala farm.
Di report bin say him get case to answer about di stealing of bundles of money from one sofa for him ranch for 2020.
President Ramaphosa still dey enjoy di support of di ruling African National Congress (ANC) party. Di party folks dey run coalition govment for South Africa.
E never clear how all Di coalition partners go vote if di impeachment process continue.
However, ANC get enough members wey fit vote to stop di removal of di president from office.
Ramaphosa don always deny say him do any wrongdoings, say di 580,000 dollars wey thiefs steal na proceeds from sales of buffaloes, but di case turn big and don cause major embarrassment as pipo dey ask why him hide so much money for him furniture.
Di case dey popularly known as "farm gate" scandal for South Africa
President Cyril Ramaphosa bin approach di court to stop di impeachment process pending im application to review di Section 89 Independent Panel report, wey find say e get case to ansa for di stealing wey happun for im Phala Phala farm.
Dem create di impeachment Committee afta di Constitutional Court rule for May say National Assembly no do well wen dem vote against implementing di panel report and say make dem start impeachment proceedings against di President.
Di president dey ask for three months break for di committee. Within dis time e dey expect say him application for review of section 89 independent panel report go don happun.
Di panel been agree say di president get case to answer for issue of stealing wey happen for him Phala Phala farm.
Di Farmgate scandal
Di Farmgate scandal start for June, wen one former South African spy boss, Arthur Fraser, file complaint wit police accusing di president of hiding di theft of $4m from im Phala Phala farm for di north-east of di kontri for 2020.
Oga Fraser, wey be loyalist of former President Jacob Zuma, allege say di money fit be some tin wey come out through money-laundering and corruption, and accuse di president of kidnapping and bribing di burglars.
To hold dat kain plenty money in dollars fit violate foreign exchange control laws.
Oga Ramaphosa don confam robbery, but say di amount dem tiff no reach wetin pipo dey tok – e also deny say im wan cover up di matter.
Some $580,000 wey buyers pay in cash for buffalo na im dem tiff under di sofa cushions for di farmhouse, e tok.
Di panel report
"I no 'hunt' for di pipo wey carry out di tiff-tiff as alleged, I no also give any instruction to any body to do any tin," e write for im reply to di panel report, according to AFP news agency.
Di panel conclude say plenty questions dey wey di president neva answer, dem call am a "very serious matter".
Too much informate no dey about di man wey e claim say pay di money for buying di buffalo, di panel tok, adding say e still neva collect di animals wey e pay for, two and a half years later.
Di panel also tok say e dey strange say dem keep di money under sofa, rather dan inside safe until dem fit go deposit am for bank account.
"We tink say di president get case to answer on di origin of di foreign currency wey dem tiff as well as wetin di money dey for," di report tok.
E add say: "Di president abuse im position as head of state for am to investigate di matter, using di assistance of di Namibian president to arrest di suspect."
Namibia president Hage Geingob bin don deny say im involve for di matter.











