'I dey depressed' - Chidimma Adetshina react as deportation case for South Africa kontinu

Chidimma Adetshina

Wia dis foto come from, Chidimma Adetshina/Insagram

Published
Read am in 7 mins

Former Miss Universe Nigeria, Chidinma Adetshina say she dey "exhausted, burnt out and depressed but she no go give up".

Dis dey come afta Court for South Africa reserve judgment for Chidinma Adetsina case as dem adjoun till 19 August, 2026.

For her Instagram stories, di former beauty queen tok for her post say "Exhausted -Yes, Burnt out -Yes, Depressed - Yes, Will I give up, No! We no dey carry las see you next month"

Ms Chidinma Adetshina dey challenge di Department of Home Affairs deportation order wey make dem drag her go court.

South Africa authorities bin arrest her for June ontop allegation say she enta di kontri illegally.

Di hearing of di case happun for Cape Town Regional Court and tori be say her legal team dey argue say Ms Chidinma Adetsina get strong ties wit South Africa.

Dem dey also argue say dem born her for di kontri and na for dia she born her son too.

She bin showface for court on Monday 20 July 2026 to challenge di move by Home Affairs to deport her from South Africa.

Chidinma bin trend afta she withdraw from Miss South Africa beauty pageant for 2024. Since dat pageant happun, she don dey face plenty challenges about her right to live for South Africa.

Di charges wey dem dey try her for neva dey clear but tori from South Africa say she dey face deportation charges afta allegation say she enta di kontri illegally.

Chidimma Adetshina

Wia dis foto come from, CHICHI VANESSA/ INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Chidimma Adetshina

Meanwhile pipo don dey react to dis tori say her legal team dey try defend her wit tori of her ties to South Africa.

Even as her legal team dey do dia best to make sure say she win di case, some South Africans say Chidinma go lose di case sake of say di grounds wey her lawyers dey use defend her no correct.

One X user @manikivana post say "Mother na Mozambique, father Nigerian and no record showing say dem born her for SA. In terms of which law wey dat kain pesin automatically acquire South Africa (SA) citizenship?

Di X user for di post add say Chidinma make her mata worse sake of say wen di tori bin come out to di public she bin no file her defence but inside she fly to Nigeria wey be her real kontri by law.

" Nigeria wia dem bin receive and bin bestow e beauty and treasure (proof of no statelessness).

Afta she don tire for her own kontri, she apply for visa wey dem deny as she be prohibited person. She challenge di visa decision? No. Instead she undermine di state as she use mago-mago enta through her mother kontri border (Lebombo) to prove

I honestly see no basis Home Affairs go lose dis case, e no dey."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Anoda part fd di tori dey tok say dem born Chidinma for Soweto, South Africa and her parents no be South African citizens or permanent residents dat time, e mean say she no automatically qualify for citizenship.

Di beauty queen born her pikin for South Africa.

South Africa Home Affairs department say her original registration dey linked to alleged fraud wey involve her mother, dis fit weaken her case.

Chidinma bin go di Cape Town Regional Court on Thursday wia she present affidavit on di steps wey she don take to regularise her status for di kontri.

South Africa tori pesin Philani Nombembe of Sunday World bin report say she bin showface for court on June 9 "On June 9, she appear for di Cape Town Regional Court afta her arrest for Summer Greens."

Im add say dem bin release her afta court postpone di case to July 16 and di Department of Home Affairs (DHA) allow her to stay for di same address wey dem see her to pursue her deportation case.

According to Sunday World Court papers wey one immigration officer Adrian Jackson file na im make authorities bin arrest and detain her for June.

Jackson say im bin sabi Adetshina "sake of one investigation wey we do bifor".

Afta South African authorities bin ban Chidinma for December 2024 in line wit dia Immigration Act, di beauty pageant queen no get legal right to stay for South Africa again.

But tori be say she enta di kontri by force afta she lie about her nationality and follow backyard enta South Africa through di Lebombo border.

Normally if dem convict resin for major immigration offenses for South Africa, di pesin fit face between 5 to 15 years imprisonment or deportation.

Chidimma Adetshina

Wia dis foto come from, MISS SOUTH AFRICA ORGANISATION

Wetin we call dis foto, Chidimma Adetshina

Di matter so far

According to Sunday World, na di Department of Home Affairs central law enforcement office na im bin dey find wia Chidinma Adetshina dey stay.

Dem later find out say she and her son wey be minor dey allegedly live for South Africa without legal status.

"For di affidavit, I go now bring reasons wey go dey in di interest of justice to detain dis pesin for di purpose of deportation to di kontri of origin."

According to di affidavit, officials bin confam Adetshina details wey dey inside di electronic system of di department, bin interview her to determine her immigration status.

"Afta di above 'status determination' interview and di Department of Home Affairs residency IT systems checks, we don confam say di applicant no hold any lawful Republic of South Africa (RSA) residential status and she be illegal foreigner," Na wetin dem write for Immigration official Jackson affidavit.

"I submit say di illegal foreigner wilfully and intentionally stay for hia as resident unlawfully for RSA in contravention of di Immigration Act 13 of 2022."

Jackson bin ask di court to "confam di detention of di illegal foreigner for di purpose of deportation so dat di Department of Home Affairs go fulfil dia full mandate to facilitate di removal of illegal foreigners from di Republic of South Africa".

Bifor now, Chidinma bin don apply to di Department of Home Affairs make dem review dia decision wey ban she and her son for 2024 but di Home Affairs Minister Dr Leon Schreiber bin dismiss her application for March wia im uphold di decision to ban her.

Tori be say di Minister of Home Affairs,Dr Leon bin write to Adetshina on September 2024 wia im tell dem say di department wan cancel her and her pikin South African identity documents.

"Di department bin notify you of di intention...in September 2024, and you failed to respond," Schreiber tok.

Im add say Adetshina collect Nigerian passport wen she bin dey for Nigeria bifor she bin apply for South African visitor visa.

"On 20 September 2024, you bin collect Nigerian passport number … while you still dey for Nigeria, and you bin apply South African visitor visa, and dem bin reject your application becos you bin submit mago-mago bank statement. You not appeal di rejection."

Schreiber add say dem declare Adetshina prohibited pesin on December 19, 2024.

"In terms of di Immigration Act, prohibited pesin no qualify for any visa or permit to remain for di Republic," Schreiber tok.

Im also allege say Adetshina later enta South Africa through di Lebombo border post from Mozambique and she bin present herself as South African citizen.

"You re-entered South Africa through Mozambique, for di Lebombo border post, on 15 June 2024, presenting yourself as South African citizen using passport number… and den you bin apply for a letter of good cause, of which you fail di good cause test wey dey inside di Immigration Regulation 30(1)."

Di minister also reject di immigration application wey concern Adetshina son.

"As di application for di minor child dey dependent on di one wey di primary applicant submit, im legal status dey linked to her," Schreiber tok.

"Sake of di rejection of di primary applicant request due to her prohibited status and di submission of fraudulent documentation, di minor child no get independent basis to remain for di Republic."

Dis dey happun at a time wey South Africa dey do evritin possible to pursue illegal immigrants comot from di kontri.

Di March and March group wey dey lead di protests since June say dem no go back down untill dem achieve dia goal.