How Nigerian states dey prepare against possible outbreak of Ebola as govment release N10bn

Nigeria minister of health Prof. Muhammad Ali Pate
Published
Read am in 6 mins

Nigeria govment don release ₦10bn ($6.7m) in emergency funding to support laboratory testing, purchase protective equipment, mobilise health workers and strengthen oda containment measures, afta di kontri confam one case of Ebola virus.

Nigeria minister of health Prof. Muhammad Ali Pate wey give dis informate for one interview wit di BBC add say, medical personnel across di kontri also dey receive additional training in anticipation of different outbreak scenarios.

Oga Pate say Nigeria dey intensify efforts to contain di only confirmed case of Ebola, and health authorities dey trace contacts, test potential exposures and don place hospitals nationwide on heightened alert.

Apart from wetin di federal govment dey do, some state govments don also dey put measures in place to contain any outbreak of Ebola virus for dia states.

Authorities for Lagos, Nigeria biggest commercial state say dem dey on high alert and dem dey treat di mata as priority.

Meanwhile, Prof Pate say di woman wey bring di infection enta di kontri dey respond well to treatment and don show significant signs of recovery.

"To be honest, we believe say she don pass di worst stage of di sickness. Her health condition don improve well well. Di enzyme levels for her body don reduce, and na signs say di inflammation don calm down. She dey active and cheerful, and she fit tok now. Dis one different wella from di condition wey she dey three or four days ago," e tok during one exclusive interview wit BBC.

Prof Pate say extensive contact-tracing operation dey go on, and dem dey focus on di two medical facilities wia di patient bin initially go for treatment bifor dem confam her infection.

Authorities dey monitor healthcare workers, laboratory personnel, cleaners plus oda pipo wey fit don come into contact wit di patient, and dem don quarantine and put under close observation dos wey dem believe say fit be high risk.

"So far we get one confirmed case. But we dey carry out many tests. And we go continue to dey update Nigerians. We get 14 laboratories wey fit test for di disease and also place wia dem dey do genomic sequencing.

"All these na to enable us carry out di necessary tests and investigations to establish weda wey come in contact wit di patient don dey infected," e tok.

To ginger di response, di govment don release ₦10bn ($6.7m) in emergency funding to support laboratory testing, purchase protective equipment, mobilise health workers and strengthen oda containment measures.

Prof Pate tok say Nigeria don activate dia emergency response immediately afta dem confam di case and dem notify di World Health Organization (WHO) within 24 hours.

"We don dey ready for dis possibility since, drawing from our 2014 experience. And since five months ago wen di govment bin set up di Ebola Incident Response Management Team, we don show capacity to handle any outbreak. Our surveillance systems, laboratories and emergency response structures dey advanced to ensure say we fit identify cases quickly and prevent further transmission," e tok.

Di minister add say dem don direct hospitals across Nigeria to establish and prepare isolation areas for suspected infections. Dem don also put federal and state health facilities on alert and don instruct dem to reinforce infection-prevention and control measures.

On Friday, 23 October Professor Ali Pate, and di head of di Nigeria Centre for Disease Control, bin follow tori pipo tok and dem provide update on di outbreak plus di genomic analysis of di virus.

Pate tok say di single confirmed case of Ebola be like say e dey genetically related to one strain dem identify earlier for Kenya, but no evidence dey so far wey show say di Kenyan patient bin travel to Nigeria, but dem still dey carry out more testing.

E make am clear say na only one confirmed case of di virus Nigeria don record so far.

"We dey carry out additional tests. Some of di results na negative, while odas dey pending," Pate tok.

Genomic sequencing na one scientific process dem dey use to examine di genetic makeup of a virus.

E fit help health officials to establish how infections dey, dey related, spread and inform di public health response.

Pate say di findings fit help guide further investigations into di origin and transmission of di infection, but e warn say di evidence wey dey no reach to establish precisely how di virus take reach Nigeria.

Meanwhile, Kenyan authorities tok say dem don trace all 135 contacts wey dem link to di kontri first case.

Wetin state govments dey do

Lagos state: Govnment say di state dey on high alert. Di state commissioner for health Prof Akin Abayomi highlight seven preparatory measures dem don put in place, wey include upgrade of isolate centres for di state, screening at aiports plus oda points of entry, simulation, laboratory testing among odas.

E add say retraining of health workers across public and private facilities on infection prevention and control don start.

"One dedicated Ebola Research Committee don dey review di latest evidence on treatment and vaccines to guide our decisions," Abayomi tok.

Delta state: Di state commissioner for health, Joseph Onojaeme say di ministry of health dey strengthen surveillance at entry points, health facilities and within communities, while prioritising regular training for frontline health workers, public awareness campaigns plus di provision of essential medical supplies to support emergency response efforts.

Di 42-year-old woman na di wife of one Swiss diplomat.

Di case wey involve di Bundibugyo strain, one rare form of Ebola virus disease wey don affect some African countries.

Health officials dey investigate weda Nigeria first case bin cross paths wit Kenya first patient. Believe dey say both of dem travel through Uganda Entebbe International Airport earlier dis month.

Ebola na one severe and often fatal disease. E dey spread through direct contact wit di blood or oda bodily fluids of infected person, or through contaminated materials. E no dey spread through di air.

Prof Pate don ask Nigerians to remain calm but vigilant, follow public health guidance and immediately report symptoms or suspected exposure to health authorities.

"We need Nigerians to cooperate wit health workers, observe di recommended public health protocols at home and for public places, and seek medical attention if dem develop symptoms or believe say dem fit don dey exposed," e tok.

However, di imported infection don bring back concerns about public health preparedness for kontri of more dan 200 million pipo, particularly for densely populated urban communities wia poor sanitation and limited access to healthcare fit increase vulnerability in case di virus spread.