Tinubu appoint former Ekiti govnor Fayose as chairman Rural Electrification Agency, name 25 odas

Ayo Fayose shake hand wit Tinubu

Wia dis foto come from, Ayo Fayose/X

Published
Read am in 3 mins

Nigeria President Bola Tinubu don announce 26 new appointments into 10 Federal govment agencies and commissions, as e appoint former govnor of Ekiti State, Ayo Fayose.

Tinubu appoint Fayose as chairman of di Rural Electrification Agency (REA).

Dis appointment come on Monday night wia President tok tok pesin, Bayo Onanuga announce di full list of di new appointments.

Fayose go now head di REA wit oda board members wey include, di incumbent DG of di agency, Abba Abubakar Aliyu, and three executive directors wey dey previously appointed.

President Tinubu make eight oda appointments to di Wages Commission, including oda federal agencies, including di constitution of di board of di Fiscal Responsibility Commission.

Full list of Tinubu new 26 appointments

  • Rural Electrification Agency (REA)

- Ayo Fayose - Chairman

- Alhaji Ahmadu Abubakar

- Engineer Ilyasu Ibrahim Makinta

  • National Salary and Wages Commission.

- Major General Junaid Bindawa - chairman

- Olajumoke Okoya-Thomas - Secretary

Former member of di House of Representatives from Lagos, Olajumoke Okoya-Thomas, na di new secretary of di commission.

Commissioners - Dr Ogbole Ene Lilian (Benue), Oladele Olatubosun (Oyo), and Yakubu Umar Barde (Kaduna)

Members - Dr Mai Adamu Yau (Borno), Ginika Florence Tor (Enugu), Engineer Lawrence Okoh (Edo) and Bello Morenike Iyabode (Kogi)

  • Revenue Mobilisation and Fiscal Commission

Tosin Johnson Adeyanju, dey previously dey appointed as di Executive Secretary of di National Lottery Trust Fund (NLTF), now dey moved to di Revenue Mobilisation and Fiscal Commission as Secretary.

  • National Population Commission

President Tinubu also appoint Dr Abuh Mohammed as Director-General of di National Population Commission

  • Nigerian Bulk Electricity Trading (NBET)

Dr Akinola Odeyemi dey appointed as Managing Director of di Nigerian Bulk Electricity Trading (NBET)

  • Nigeria Atomic Energy Commission

Dr Anthony Inalegwu Godwin dey appointed as chairman/CEO of di Nigeria Atomic Energy Commission

  • National Centre for Agricultural Mechanisation(NCAM)

Engineer Julius Oloro, former council chairman, na di new CEO of di Kwara-based National Centre for Agricultural Mechanisation(NCAM), to replace Dr A.R. Kamal, wey die last January.

  • Fiscal Responsibility Commission,

Dr Abdullahi Maikano Saidu - chairman.

Mohammed Asmau – Board member

Mohammed Aliyu Makama – Board member

Dr Suleiman Gidado – Board member

Louis O. Ndukwe – Board member

Amaechi Ugwele – Board member

Olaniyi Idowu Onikola – Board member

  • National Commission for Mass Literacy, Adult and Non-Formal Education

Shuni Muhammad Dahiru na di new executive secretary of di National Commission for Mass Literacy, Adult and Non-Formal Education, to replace Professor Shu'aibu Shehu Aliyu, wey dey reassigned to di Petroleum Trust Development Fund (PTDF) for April.

To replace Mathias Byuan, di former executive director, finance of the Federal Housing Authority, wey resign to contest di govnorship election for Benue, President Tinubu name Gisaor Vincent Iorja.

Di president say all di appointment take effect immediately.