Ice explain why dem drag out Nigerian man from hospital for New York to arrest am

Wia dis foto come from, Screengrab/Freedom Tv
United States Department of Homeland Security tok say dem arrest one Nigerian man, Chidozie Wilson Okeke, ova im alleged previous criminal record of "assault and illegal drugs possession".
Inside one footage wey dey circulate ontop social media, e show how US Immigration and Customs Enforcement (Ice) agents drag Okeke for floor wit handcuffs, afta dem drag am out of di hospital and put am inside dia vehicle.
Di incident happun for Wyckoff Heights Medical Center, for New York on Saturday night.
On Saturday night, protest bin break out for front of di hospital ova Okeke arrest by di federal enforcement agency, resulting in di arrest of some of di anti-Ice agitators.
Many of di anti-Ice agitators gada for front of di hospital to protest against di mass deportation by Ice under di President Donald Trump adminstration.
However on Monday, Ice tok say dem arrest Okeke becos of im alleged illegal possession of drugs and di overstay of im visa for di kontri since 2023.
Inside on statement on Monday, Ice explain say afta dem conduct one targeted enforcement operation for Brooklyn dem arrest Chidozie Wilson Okeke, Nigerian man ova im criminal record of assault and criminal drug possession.
Di federal enforcement agency explain say as dem dey try arrest Okeke ova im criminal record, but e refuse to comply to di "lawful command" of di officers and e dey try to fight back but di officers use "minimum amount of force" to make di arrest.
"During im arrest, Okeke refuse to comply wit officers lawful command to leave di vehicle and e try to weaponise di vehicle as e attempt to hit ICE officers.
"Okeke become physically combative attempting to punch and elbow ICE officers. Our officers followed their training and used the minimum amount of force necessary to make di arrest.
Di agency tok say afta dia agents arrest Okeke dem carry am go hospital for medical evaluation but e refuse to comply as e begin "throw imself to di floor and e dey scream."
Ice tok say di crowd wey gada in front of di hospital become violent and dem begin to destroy "Ice vehicles and assault dia officials."
Di agency tok say dem arrest di protests wey assault dia officers becos na felony and crime.
"Afta di arrest, Okeke request medical assistance, so ICE officers follow am to Wyckoff Heights Medical Center for medical evaluation. Okeke remain non-compliant during di medical evaluation as e dey throw imself to di floor and e dey scream. Di medical staff clear am.
"During di medical evaluation, large crowd of anti-ICE agitators gada for di hospital and become violent.
"Di protestors damage several ICE vehicles and assault ICE officers, dis result for minor injuries to di officers.
"Assaulting law enforcement na felony and crime. Officers from di New York Police Department respond to di scene and arrest several rioters."
For February, US Department of Homeland Security annouce say dem go deport Nigerians wey dia names dey on di kontri "worst of di worst" criminal list.
Since, US President Donald Trump don return to office, Ice don arrest thousands of foreigners to track down illegal immigration.
US annouce say dem go deport ova 1,000 illegal immigrants.
Seventy-nine Nigerians and 18 Ghanaians, including citizens of oda African kontris wey dem describe as 'criminal illegal aliens' dey di list.










