Oyo teachers start strike ova kidnapped students, Tinubu approve 1,000 forest rangers

Wia dis foto come from, Channels TV
Di Oyo State chapter of di Nigeria Union of Teachers (NUT) don start indefinite strike dis Monday morning sake of di primary school pupils and teachers wey jaguda pipo bin kidnap from three schools for Ogbomoso, Oyo State.
Dis strike go affect all di primary and secondary schools for di state, and di union leaders say e go eventually go nationwide if di govment no rescue di kidnapped victims.
BBC News Pidgin bin don report how gunmen bin attack Ogbomosho community on Friday, 15 May 2026, and kidnap primary school pupils and teachers from LA School and Community Grammar School, Ahoro-Esinele.
Local tori tok say na about 46 pipo bin dey affected, including seven teachers and 39 school children. Di bandits kill one school teacher during di attack, and later also kpai anoda teacher inside di forest.
Dat same Friday, for Borno State, anoda 50 students bin also dey kidnapped from Mussa Central Primary Schools for Askira-Uba local govment area of Borno State.
For one statement by di Oyo State chairman of di NUT, Hassan Fatai, tok say di strike na "to draw di attention of govment authorities to di urgent need to put more efforts to secure di release of di abductees witout further delay".
Di union also tell dia members across Nigeria to hold protest on Tuesday, 2 June 2026, and march to di govment house for dia States wia dem go address tori pipo and call on govment to provide more protection for teachers and students for dia various schools across Nigeria.
Tinubu send representative to Oyo State
Dis strike action by di Oyo State NUT dey come just a day afta President Bola Tinubu send im Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, di Minister of Defence, Christopher Musa, and di Inspector General of Police, Tunji Disu, to Ogbomosho, to visit di place wia di kidnapping bin hapun, and to console di pipo affected.
Di govnor of Oyo State, Seyi Makinde also join di presidential delegatio to visit di community wia dem again promise di pipo sa govment must do evritin for dia power to resuce di students and dia teachers.
One pikin wey dey two years old folo for pipo wey di bandits kidnap, and according to Ribadu, e describe am as "nothing but evil".
"We share for your pains and agonies. Di perpetrators of dis dastardly act dey evil. Di Federal Govment go make sure say we go bring dis inglorious act to end nationwide," e tok.
Gbajabiamila tok say dis current situation dey really pain President Tinubu and e don direct make security authorities do "whatever e go take" to bring di kidnapped children and dia teachers back home.
"Your pain and anxiety dey understood. By di grace of God, your children go return safely to your arms," e tok.
Defence Minister Musa also announce say di President dey committed to use forest guards and local security groups to help di security agencies to provide security for rural communities.
"Like di Chief of Staff bin tok, President Tinubu don approve di immediate recruitment of 1,000 forest rangers for Oyo State," Musa tok as e promise say dem go also consider oda security requests by di pipo.
As of dis Monday, e don pass two weeks wey di students and dia teachers, including di school principal and di two-year-old pikin, don spend for di forest wit di jaguda pipo.
Di same tin also dey hapun for di case of di 50 students wey bandits kidnap for Askira-Uba, Borno State on di same 15 May. Dem still dey for captivity reach now and e come be like say both di govment and di media no dey too tok about dem.
Dis fit be sake of di killing of one of di teachers wey. di bandits bin video and circulate am on top social media. E also fit be sake of say mass kidnapping of students don dey turn regular tin for di northeast region of Nigeria wia Borno State. dey located.
Na for Borno State di first eva mass kidnapping of school Children bin hapun for Nigeria, and dat na di Chibok Girls case, wia Boko Haram terrorists bin pack more dan 270 girls from Govment Girls Secondary School, Chibok, for April 2004.
Di Nigeria govment later rescue some of di girls in batches, but up till today, more dan 22 years afta, about 90 of di girls still neva return to dia parents and hope don dey go down on weda dem go eva come bak again.










