You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Authorities arrest Adeniyi Adeyemi ontop fake agency PFIPC afta court arrest warrant
Di Director-General of di govment agency wey no dey exist don chop arrest afta Court issue arrest warrant.
Mr Adeniyi Adeyemi wey allegedly name imsef as Director General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) bin no showface for court two times wey make di judge para.
Authorities for Nigeria arrest am sharp-sharp afta Justice Mohammed Umar of di Federal High Court, Abuja issue arrest warrant on Tuesday.
Govment accuse Adeyemi say e bin dey pose as Director General of one Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), wey govment say no agency like dat dey exist and say di President no appoint Adeyemi to di position as e dey claim.
Dis dey come afta di judge, Mohammed Umar, call Adeyemi case number but e no show up for courtroom.
Wen di mata come up at about 3pm on Tuesday, counsel to do Nigeria govment, Wisdom Madaki tell Di court say di defendant no dey for court even though dem don serve am di court summons.
Madaki ask di court to issue bench warrant against di defendant so dat security officers go arrest am and bring am to court on di next adjourned date.
Di defendant lawyer, Genesis Francis, tell di court say im client dey fear for im life and e bin don write open letter to president Bola Tinubu to beg for protection.
But Justice Umar reply say di court go make sure say di defendant dey alive to face im trial.
E grant di order of arrest and adjourn di matter to 30 September for arraignment.
Wetin be di charges wey Adeyemi dey face
Count one: Say Prince Adeniyi Adeyemi Mathew 'M' 38 years for 2nd Floor, Federal Secretariat Complex Abuja, Femi surname unknown and Anu surname unknown dey run, on or about 8th March, 2024 within diJurisdiction of dis Honourable Court, una conspire among una sef to commit felony wit forgery, and don commit offence wey dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of Nigeria.
Count two: Say you Prince Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown dey at large, on or about 8th day of March, 2024 within di Jurisdiction of dis Honourable Court forged appointment letter say di president Bola Ahmed Tinubu sign wit Chief of Staff Femi Gbajabiamila, and commit offence wey dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of di Federation of Nigeria.
Count three: Say you Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, on or about 8th March, 2024 for dis Honourable Court jurisdiction, forge Presidential Letter Headed Papers, and commit offence wey dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of di Federation of Nigeria. Nigeria.
Count four: Say you Prince Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, on or about 8th March, 2024 within di jurisdiction of dis Honourable Court, forge request for collaboration wit Ministry of Land requisition and offices all across di 36 states of di federation wey claim say na state House Abuja Nigeria issue am, and thereby commit di offence wey dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of Nigeria.
Count five: Say you Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, sometime between 2024 and 2025 for dis Honourable Court jurisdiction, you dey pretend to be Director General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, and thereby commit offence wey dey punishable under section 179 of di Penal Code.
Count six: Say you Adeniyi Adeyemi Mathew, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, on or about 8th March, 2024 for dis Honourable Court jurisdiction, forge request for office space, wey claim say na from State House Abuja, Nigeria, and thereby commit offence wey dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of di Federation of Nigeria.
Count seven: Say you Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, on or about 8th March, 2024 for dis Honourable Court jurisdiction, forge request for approval of Staff Accounts status wey claim say na from State House Abuja, Nigeria, and thereby dey punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of Nigeria.
Count eight: Say you Adeniyi Adeyemi, Femi surname unknown and Anu surname unknown wey dey run, on or about 8th March, 2024 for dis Honourable Court jurisdiction, forge conveyance approval Re-Take off Presidential Economic Advisory Council / Presidential Foreign Intervention Promotion Council, wey claim say e come from State House Abuja, and thereby commit offence punishable under section 1(2)(c) of Miscellaneous Offences Act Cap M 17 Law of di Federation Nigeria.
Brief background
On Wednesday, 1 July 2026, presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga accuse Adeyemi say e use fake documents wit forged signatures and seals, to dey claim leadership appointment for office wey no dey exist.
E also tok say police don chook eye for di mata and dem establish say di agency wey Adeyemi claim say e be di DG na fake, and say di man bin forge im appointment letter plus oda documents wey police recova from im house and office.
"Di case of Prince Adeniyi Adeyemi Matthew na clear case of con artist wey don build web of false claims to deceive unsuspecting govment officials and di public into playing by im scam book," Onanuga tok for im statement.
"For November 2016, im (Adeyemi) bin parade imsef as ambassador and President-General of di World Youth Organisation (WYO), wey be affiliate of di United Nations (UN)... Di local media bin dey celebrate am until di UN later deny say such a bodi exist," di presidential tok-tok pesin add.
However, Adeyemi bin don deny di allegation wey both Onanuga and Gbajabiamila dey put on im head.
For statement wey e release on 26 June 2026, e claim say e get documents to show say true-true Presido Tinubu give am appointment.
Adeyemi tok say di PFIPC wia e be Director General get account wit di Central Bank of Nigeria (CBN), and di govment bin allocate money to dem for di 2026 budget.
"Make we assume for one second say evritin wey di Chief of Staff publish na true, say di agency no dey exist. Den how di agency name take enta di 2026 appropriation budget for pages 50 and 51?" e ask.
"Dis issue no longer be about personalities. Na about contradictions wey demand answers," e tok.
Adeyemi call on President Tinubu to set up independent investigation to torchlight di mata between am and Gbajabiamila.
"Di purpose na clarity: no be denial versus counter-denial. If I dey wrong, let di independent process prove am. If Honourable Femi Gbajabiamila dey right, make dem confam am," e tok.
BBC News Pidgin check di website of di Budget Office of di Federation and we see true-true say di PFIPC get budget allocation and dia name appear for page 50 and 51 of di 2026 budget.