You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Borno parents appeal to govment to rescue dia children wey gunmen kidnap same day wit Oyo schoolchildren and teachers
Parents of di children wey gunmen kidnap from Mussa, for Borno State northeastern Nigeria on 15 May, don urge Nigerian authorities to intensify efforts to secure dia release.
Di parents make dis appeal afta di release of di Oyo State schoolchildren and teachers wey gunmen kidnap di same day di Borno kidnapping incident happun.
One of di parent wey follow BBC News Pidgin tok Bukar Buba, say dem dey "furious" as dia own children wey dem kidnap di same day di Oyo incident happun still dey for captivity.
Oga Buba say dem no happy as dia children still dey captivity, and appeal to Nigerian authorities for quick intervention to secure di release of dia own children too.
"All di days we live and no see our children we no happy, we no know how dem dey survive inside bush, especially for dis rainy season. We don cry and beg govment to help rescue our children, but up till now, we no hear anytin about dia release," Oga Buba tok.
President Bola Tinubu say dem secure di release of di abducted children and dia teachers witout any collateral damage. E also confam di arrest of eight of di kidnappers, wey e claim be Ansaru terrorists, and say dem kpai odas wey get hand for di operation.
E attribute di release of di abducted schoolchildren and teachers to di heroic efforts of security operatives.
Di Borno schoolchildren kidnap incident
Na on 15 May, gunmen kidnap more dan 50 children from three schools for di same town for Mussa, Borno State, northeastern Nigeria.
Di kidnappings happun for di town Government Day Secondary School, Mussa Central Primary School, and State Universal Basis Education Board (SUBEB) Secondary School.
Most of di children dem carry dey between di ages of two and five years old.
Pipo wey witness di attacks tok say di suspects bin use di children as human shields as dem run away on motorbikes, and dat stop security forces from opening fire.
No group don claim responsibility for di attacks.
Parent tok wetin dey delay di Borno kidnap rescue
Oga Buba wey di gunmen snatch in six-year-old daughter tell BBC News Pidgin say two weeks ago, Borno State commissioner of education bin meet wit parents of di victims and e tell dem to exercise patience as dey dey "put all dia efforts to negotiate wit di kidnappers".
"Di commissioner of education meet wit some of di parents and inform us say dem dey about to negotiate to pay ransom for di children, Buba add.
Nigeria govment don clear am say payment of ransom to kidnappers dey illegal. One 2022 law bin criminalise di payment of ransoms, and govment don often deny report of payment of ransom to kidnappers.
For November 2025, wen terrorists kidnap more dan 200 pupils and staff from one Catholic boarding school for Papiri, Niger State, northcentral Nigeria, tori bin spread say govment pay "huge" ransom to Islamist militant group Boko Haram to secure dia release. But di Information Minister Mohammed Idris bin describe di allegation as "completely false and baseless" and "disservice to di professionalism and integrity" of di security forces.
Meanwhile, di police for Borno State say joint security efforts dey go on to secure di release of di abducted school pupils.
Tok-tok pesin to di Borno State Police Command Nahum Daso confam to BBC News Pidgin say di school children still dey captivity and investigations still dey go on.
On di day di incident happun, Abdu Dunama, headmaster of Mussa Central Primary School, tok say im hear gunshots bifor armed men storm di school and pack di children.
E say di attackers carry 34 children - mostly nursery pupils aged five and under from dia classrooms.
Di suspected militants bin land di schools on motorcycles as soon as sojas wey dey patrol di area comot di town, according to residents.
"[Na] immediately dem comot, e no reach 30 minutes afta dem come," Oga Buba tok.
Eyewitnesses say di gunmen fire gunshots anyhow, and e force residents to run for cova. Many parents bin watch helplessly from one nearby hill as dem load dia children on motorcycles and carry dem away.
As no group don claim responsibility for di attack, some reports bin suggest say di attacks bear di hallmark of Boko Haram - di Islamist group wey wan gain control ova di region against dia rival faction, Islamic State West Africa Province (Iswap).
Locals for Borno State don endure decades of insecurity, as dem always dey for di middle of several kidnapping incidents and terrorists attacks for di kontri.
However, Nigeria military ova di weekend tok say dem scata one attack wey Iswap fighters bin wan carry out for di Cross Kauwa area of Borno State, as dem kill several militants and force odas to run.
For inside one statement wey di military tok-tok pesin Captain Mohammed Goni issue on Sunday, 12 July, e say di attack bin happun late on Saturday night wen di fighters bin try to infiltrate one military position.
Di military also say di attackers bin dey try to loot cholera medical supplies for di area.
Borno State plus oda parts of northern Nigeria dey often experience cholera outbreaks during di rainy season, as years of conflict and displacement don affect access to clean water and sanitation.
Captain Goni tok say di military bin detect di movement and respond wit "coordinated and overwhelming firepower", wey force di fighters to abandon di attack.
According to di military, preliminary analysis of di footage suggest say na four senior Iswap commanders alongside three foreign operatives coordinate di attack.
Di military identify one of dem as Palestinian Arab wey dey known as Abu Ishaq, wey dem describe as Iswap overall trainer.
Dem also identify one Moroccan Arab, Abu Thaiba, wey be doctor wey dey work wit di group. Dem still dey investigate di identity of anoda foreign suspect.