Who be John Ternus wey Apple take replace Tim Cook afta 15 years

Read am in 4 mins

Apple don announce say John Ternus go be dia new chief executive to replace Tim Cook wey dey comot afta 15 years wey im don dey lead di technology giant.

Oga Ternus dey work as di current oga of hardware engineering for Apple wia e don dey work for 25 years.

E go take ova from 1 September and Cook go come turn executive chairman.

Cook don dey work as di chief executive of Apple since 2011 wey be wen co-founder Steve Jobs resign for health reasons just bifor im bin die.

Cook go remain as chief executive for now so e go fit work wit Ternus for di transition afta dat im go come dey "help wit certain aspects of di company, wey go include to dey follow policymakers around di world to tok".

Cook decision say e go comot as CEO dey come afta months of speculations say di Apple oga wey just turn 50 years dey find successor.

E bin call di work, "di greatest privilege of my life. Dis na as for im tenure e don lead di company to turn one of di most valuable companies for world.

For 2018, Apple bicom di first public company wey go dey valued at $1 trillion (£740bn) now dem dey worth $4 trillion.

Cook call Ternus say im be "visionary" executive wit "di mind of engineer, di soul of innovator and di heart wey dey lead wit integrity and honour".

Cook add say, " e be without question, di right pesin wey go lead Apple ot di future."

E be like dem start to dey eye Termus to replace Cook last year afta anoda long time executive, chief operating officer Jeff Williams bin comot from di company.

For statement on Monday, e call Cook im mentor and tok say "I dey full of optimism about wetin we fit achieve for years to come".

Reuters tori pipo tok say, at 50, Ternus dey take ova Apple at di same age wey Cook bin take ova from Jobs for 2011.

Who be John Ternus?

John Ternus don spend 25 years for Apple wia e don chook hand inside basically evri major product di company don drop.

Dis include all di generations of di iPad, many generations of di iPhonee and di launch of di AirPods and di Apple Watch.

E bin also oversee di move of Mac computer dia processors from wen dem stop to dey use Intel and start to use Apple own silicon.

Tori pipo Reuters report say e bin join Apple product design team for 2001 and dem bicom vice president of hardware engineering for 2013.

Na for 2021, wey dem promote am to di work wey im dey do now as senior vice president of hardware engineering.

Dem also credit am wit di re-ginger wey di sale of Mac computers start to get sotay dem gain beta part of di market.

Last year, Termus bin show di biggest iPhone change since 2017 wen e unveil di iPhone Air.

Bifor e work for Apple, e bin dey Virtual Research Systems as mechanical engineer. E get bachelors degree for Mechaical engineering from di University of Penslyvania.

Sabi pipo for di technology space don dey excited about di change in movement of di company as dem call cook di administration guy while dem dey reason say Ternus go deliver on innovation wey dem don dey fire Apple about.

Di most recent criticism na about how Apple no quick enta di AI rush sotay now dem don dey usee oda pipo AI for dia products.

Dipanjan Chatterjee, a principal analyst at Forrester bin hail di financial stabilty wey COok bring come Apple but say e neva give di company anoda product wey go rival iPhone and na dat kain tin go give Ternus anoda 20 years of success.

E advise di new leader make e, "resist di temptation to just dey increase wey don dey wit Apple recently and comot di iPhone gravitational pull".

Gil Luria, managing director at DA Davidson & Co tok say wit someoene wey dey so hardwarefocused as oga, e go mean sat Apple go wan come put more energy for new products like foldable phones and wearable devices like glasses.