ISWAP Chief finance officer, im two sons and 46 odas surrender to di Nigerian Army

Nigerian Army tok say ISWAP Chief finance officer and im two son don surrender to di Nigerian Army

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X

Published
Read am in 4 mins

Di Chief finance operative of di Islamic State West Africa Province (ISWAP) wey be key senior officer of di terrorist group don surrender to di military, Nigerian Army tok.

Di Acting Military Information Officer of di Theatre Command, Captain Mohammed Goni, announce dis informate for statement on Sunday.

E say preliminary profiling show say di terrorist dey serve as di Chief finance operative of di ISWAP enclave for Jubillaram, wia e dey responsible for managing di group financial activities and logistics.

"E surrender alongside two male children," Capt. Goni add.

"Di terrorist surrender to sojas of 3 Battalion under 24 Task Force Brigade at about 6:45 a.m. on 25 July 2026 along di Ladari–Jegarawa–Tunokalia axis on di Gamboru–Wulgo Main Supply Route.

"Im decision to lay down im arms follow di recent series of coordinated and decisive land and air offensives wey Operation HADIN KAI carry out against terrorist enclave," di statement read in part.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Captain Goni say items dem recover from di terrorist include one AK-47 rifle, four magazines, 101 rounds of 7.62 mm special ammunition, one motorcycle, and di sum of ₦40,000.

E say dem dey profile and interrogate am for more information wey go support ongoing operations and facilitate di targeting of remaining terrorist elements across the Theatre.

Apart from di chief finance operative, Capt. Goni say anoda 46 terrorists plus dia family members don voluntarily surrender to di Nigerian Army in recent times.

Di president say dis na as part of effort to strengthen di kontri security structure and improve how di military dey carry out dia operations.

Meanwhile, operation HADIN Kai say di surrender of such key finance operative represent anoda significant setback for ISWAP, and e show as dem dey crush di group command structure, operational capability, and sustainment network.

"Coupled wit di increasing number of recent surrenders, dis development confam say all no dey okay within di terrorist ranks and e point to di heavy wave of defections from terrorist camps," di Army tok.

Di Theatre Command advice all di remaining terrorists to take advantage of di Nigeria govment non-kinetic initiatives by laying down dia arms bifor e dey too late.

Dis no be di first key ISWAP terrorist wey go surrender in recent times.

Dem surrender afta di death of one IS Commander Abu-Bilal al-Minuki, wey Nigeria govment and di United States kpai for inside one joint operation.

As terrorists dey surrender to di Nigerian military, concerns however dey on di rehabilitation programme govment set up for repentant terrorists for di kontri North East region.

Di Nigeria Senate for one of dia sittings for early July bin pass one motion to di executive arm of govment to immediately stop di rehabilitation programme for ex-boko haram fighters.

Di military say dem no go stop dia operations against Boko Haram and ISWAP. Dem say dem go kontinue to do offensive operations to 'hunt down and eliminate di remnants of Boko Haram and ISWAP'.

Army say dia mission na to restore complete peace to di North East region of di kontri.

For more dan 15 years now, insurgency don dey happun for North-East Nigeria.

E start for 2009, wen militant group Boko Haram launch dia first major attack against di Nigerian govment.