Two high-profile Iswap commanders surrender to Nigerian Army - who dem be and wetin authorities go do wit dem

Two alleged Iswap commanders surrender to Nigerian Army

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X

Published
Read am in 4 mins

Two high-profile Islamic State West Africa Province (Iswap) commanders don surrender to di Nigerian Army.

Di Nigerian Army wey announce di informate identify di surrendered terrorists as Ismail Mohammed and Abu Umar.

Currently dem dey military custody and dey undergo appropriate profiling and debriefing procedures, di military add.

"Operation HADIN KAI don record anoda ogbonge success for di ongoing counter-terrorism campaign afta two high-profile Islamic State West Africa Province (Iswap) commanders surrender to troops on 8 June 2026," Acting Media Information Officer, Haruna Sani for operation Hadin Kai tok.

Dis victory dey come as wave of kidnappings and insecurity intensify for di kontri.

Also, di surrender dey come afta di death of one IS Commander Abu-Bilal al-Minuki, wey Nigeria govment and di United States kpai for inside one joint operation.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Who dem be?

According to di statement wey di Nigerian Army issue on Thursday, 11 June, di two terrorists hold strategic positions within di terrorist hierarchy and dey operate within di Mangari axis of di Lake Chad region.

One of di surrendered commanders, Ismail Mohammed na close associate of senior Iswap leader Baa Shuwa and e get extensive knowledge of di group command structure and activities.

Di second individual, Abu Umar, dey veri popular within di terrorist network as a skilled explosives specialist.

Im work na to build and maintain vehicle borne improvised explosive devices plus oda combat-support equipment wey terrorists dey use.

However, no details on dia age, wia dem come from and wetin go happun next afta dem surrender.

Meanwhile, di Nigerian Army confam say one high profile terrorist, Mohammed Khalifa, wey be member di Iswap Shurah Council die during di joint operations wey Operation HADIN KAI bin lead.

"Di surrender of di two commanders represent major setback to di terrorist organisation, particularly wit dia experience, influence and technical expertise wey dem don gada ova several years within di insurgent network."

Nigerian military say dia decision to run and surrender further prove di effectiveness of sustained offensive operations by troops of Operation HADIN KAI wit di support of Allied Partners against terrorist enclaves across di Theatre.

"Di combined pressure from dis operations continue to bring down terrorist capabilities, weaken dia operational networks, and force many of di insurgents to surrender," di Army tok.

For May, Nigeria and di United States confam say dem kill one senior Islamic State (IS) leader inside one joint-operation.

US President Donald Trump describe Abu-Bilal al-Minuki as di "second in command of ISIS globally" and "di most active terrorist for di world".

Dem kill am along wit "several of im lieutenants" during one strike on im compound for di Lake Chad Basin, one huge region of waterways and swampland wey Nigeria, Chad, Niger, and Cameroon dey share.

IS don radically shift in recent years, as around 90% of dia attacks now dey veri effective for sub-Saharan Africa.

Dia base for Nigeria by far na di most active.