African kontris wey don evacuate citizens from South Africa as Ghana bring back almost 1,000, Malawi welcome 150

Zimbabwe don bicom di latest African kontri to evacuate dia citizens from South Africa sake of xenophobic attacks.
Di govment on Monday, 8 June announce say dem repatriate 74 of dia nationals wey dey worry about di anti-immigration protests ova di weekend.
Di evacuation dey come as several African countries don begin comot dia citizens from South Africa ova fears of anti-immigration protests and reported attacks on foreign nationals.
E also dey come as tension dey rise ahead of di 30 June deadline wey anti-migrant groups set for illegal migrants to comot di kontri.
Zimbabwe action dey come afta Ghana, Malawi, Mozambique don evacuate hundreds of dia citizens, and as several oda kontris dey prepare to evacuate dose wey wan return home.
Last weekend, plenty African migrants bin run comot dia houses for Overberg region of South Africa Western Cape Province afta tori of door-to-door intimidation, plus di deaths of two Mozambicans for Mossel Bay.
Many bin run go hide for di community halls, for beach or nearby mountains.
Some bin choose to return to dia kontri like nationals of Malawi and Mozambique wey about 140 of dem go back dia countries through bus.
For Durban, foreigners dey camp outside di city home affairs department for several weeks, dem say dem fear for dia lives.
Malawi
Authorities for Malawi say dem repatriate 150 nationals from South Africa sake of di growing worries about xenophobia.
Di Ministry of Foreign Affairs and International Cooperation for one statement on X say di citizens wey dem move under di Voluntary Repatriation Exercise by bus on Saturday go land Malawi on Monday, 8 June.
Di repatriation exercise dey come afta one kasala burst for South Africa Western Cape Province recently, wey lead to di death of two Mozambicans for Mossel Bay and afta reports of door-to-door intimidation.
"Di 150 Malawians dey "among a number of foreign nationals" wey "seek refuge in temporary camps" for Mossel Bay, according to a statement from Lilongwe.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Ghana
For di end of May, Ghana bin organise one repatriation flight from Johannesburg for nearly 300 of dia citizens.
A group of about 680 more land for Ghana capital, Accra, during di weekend.
Dis one make am nearly 1000 Ghanaians wey di govment don evacuate comot from South Africa.
Officials say dem screen all di returnees and register dem as dem land Accra airport as part of one coordinated govment process.
Ghana Foreign Ministry say na contingency budget allocations dey fund di evacuation.
Dem also call on local businesses to support reintegration efforts by offering employment opportunities to dose wey dey return.
Di ministry add say dem dey consider legal steps to seek compensation for citizens wey allegedly lose property or wey dia businesses dey destroyed during recent unrest for South Africa.
"We go ensure reintegration wit dignity, medical and psychosocial support, pursue compensation for dose wey leave dia properties and businesses behind, secure jobs for pipo wey fit work and ginger our efforts towards achieving Osagyefo Dr. Kwame Nkrumah Pan-African dream of genuine African integration," di kontri foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa tok.
However, on Saturday, South Africa Foreign Minister Ronald Lamola bin accuse im Ghanaian counterpart say e dey spread misinformation about xenophobia for South Africa.
For one post on X, wey e link to one interview wey Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa give one news station for Accra, Lamola describe wetin e hear as "deeply disappointing".
For di interview, Ablakwa bin tell Joy News say im dey proud of di solidarity wey Ghanaians don show in supporting dia fellow nationals.
E also tok about tori of foreigners wey die afta dem attack dem for South Africa and e repeat di calls wey e make earlier say make African Union (AU) investigate wetin dey happun.
In response, Lamola clear am say di two Nigerians and five Mozambicans bin die for separate acts of violence.
E also clear am say im govment "no get information" on Oga Ablakwa claim say some Ghanaians dey receive treatment for hospital for South Africa afta dem dey attacked.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Zimbabwe
Zimbabwe wey be di latest to kontri to arrange transport for dia nationals wey dey concerned about anti-migration protest for South Africa tok say di citizens land on Sunday.
Di govment say di citizens leave South Africa on Saturday by road through di Beit Bridge border crossing.
Dem add say some families wit young children wey dey among dose wey dem evacuate tok say dem run comot di Western Cape for dia safety.
Dis dey come as South Africa President Cyril Ramaphosa announce new measures to tackle illegal migration for di kontri.
Mozambique
Mozambique govment don also begin repatriate dia nationals from South Africa.
Ova di weekend one group of about hundred and forty (140) pipo, mostly from Malawi and Mozambique, bin return home by bus afta dem live for one community hall for nearly one week inside di town of Kleinmond for di Western Cape.
Mozambique say ova five hundred of dia citizens don alreadi return and more dey set to follow.
Di decision to remove dia nationals from South Africa bin come afta two Mozambique men aged 27 and 43 die for South Africa Mossel Bay afta one violence for di Western Cape, authorities tok.
For one earlier statement, di Mozambican govment tok say five of dia nationals don die "as direct consequence of xenophobic attacks". But di police for South Africa no give motive and say investigation dey go on.
Mozambique govment allege say 800 of dia citizens be "victims of xenophobic attacks" during one recent kasala wey burst for di kontri.
Dem add say 300 pipo don comot South Africa and di remaining 500 go soon join. Two out of dem die for road accident.
Nigeria
Nigeria don postpone di first planned evacuation flight for 270 of dia citizens wey suppose comot on Monday, 8 June.
Tok-tok pesin for Nigeria foreign affairs Kimiebi Imomotimi Ebienfa say dem don "reschedule am for Wednesday, 10 June sake of unforeseen logistical considerations".
Di aircraft, wey bin dey expected to comot Johannesburg on Monday evening wit about 270 passengers, dey delayed as authorities finalise operational arrangements for di repatriation exercise, Ebienfa add.
Officials say more dan 500 Nigerians so far don dey screened and cleared for return as part of one wider govment response following rising anti-migrant tensions and unrest wey dey target foreign nationals for parts of South Africa.
President Bola Tinubu don approve five evacuation flights in total, as dem extend screening and registration of affected citizens to Wednesday. Authorities say processing applicants still dey go on.
Di ministry add say dem go announce further details on departure time and arrival for Lagos once dem receive final clearance.
Meanwhile, on Sunday, South Africa President Cyril Ramaphosa bin announce new measures to crackdown on illegal migration as tensions dey rise ova anti-foreigner marches and frustrations about high unemployment.
Dis steps include jailing employers wey hire undocumented workers, setting up dedicated courts to speed up deportations of undocumented migrants and to get register wit biometric data "for evribodi for di kontri" to stamp out identity theft.
But e also warn South Africans say make dem no take laws into dia own hands.
South African protesters don accuse illegal migrants say dem dey put pressure on public services, and say dem dey commit crime.
Di protesters don ask di govment to strengthen immigration enforcement, wey don lead to rising anti-foreigner sentiment.
Several African kontris wey include Kenya, Malawi, Lesotho and Zimbabwe don issue advisory and warn dia citizens to dey vigilant.
Xenophobia for long don bicom issue for South Africa, wey dey sometimes come wit outbursts of deadly attacks.










