Nigeria Football Federation President Ibrahim Gusau don resign

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Ibrahim Gusau
Di president, general secretary and executive committee of di Nigeria Football Federation (NFF) don resign, as dem leave leadership vacuum for di top of di sport for di kontri.
Outgoing president Ibrahim Gusau – wey im tenure suppose expire in 34 days – confam say im dey step down during one news conference for Abuja on Thursday.
E say im decide to resign "afta consultation wit family, friends and stakeholders".
E neva dey clear who go replace Gusau as di NFF president.
Gusau wey dem elect for September 2022, bin face increasing criticism ova di performance of Nigeria national and youth teams, but many pipo still expect am to contest re-election.
"Wen we win bronze for Morocco, pipo no complain becos pipo see hope. I dey proud to say I contribute to art of di success," Gusau add.
During di press conference, Gusau say im name dey spread evriwia for different tok tok wey pipo dey carry about am.
E say during im administration as NFF president, e get tins wey im do to make di football situation beta.
End of Di one wey oda users dey read well well
"On referees, we meet bad situation but we try our best to engage some young hands. Infrastructure na issue wey we meet on ground."
"We siddon and see say we lack infrastructure and accommodation for di players," Gusau tok during di conference.
"Di only reason why we no tok bifor now becos say we sign contract. My name dey spread evriwia, but I dey comfortable and I appreciate di opprotunity to serve di NFF."Bifor now, NFF bin set up committee wey go chook eye inside football for di kontri and di wahala wey e dey face.
Di mandate of di six man committee na to find out why football no dey go well for Nigeria again.
Na afta many Nigerians dey para sake of how Nigerian football don fall yakata under di Ibrahim Gusau-led NFF.
While some pipo say make e resign as e don fail Nigerian football as dem accuse am say e dey carry football for di kontri dey go wia dem no know, odas tok say make Nigerians give am time for im second term to perform.
Wahala wey NFF president enta bifor e resign
Nigeria men bin fail to qualify for di last two World Cups, but pressure on di NFF hierarchy bin intensify in recent weeks afta .
Dis bring full stop to di kontri perfect attendance record for dos finals since e start for 1991.
Di team bin go di recent Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) as defending champions but Cameroon knock dem out for di quarter-finals bifor dem lose World Cup play-off against South Africa.
"Going forward, I know say di future of Nigerian football go dey great," Gusau tok.
"I hope say we go continue to give our contribution, becos our experience and di connections and relationship we get within African football, we no go ever allow am go in vain."
Even though Super Eagles reach di final of di 2023 Africa Cup of Nations under Gusau leadership, wia dem finish as runners-up, dem miss two World Cups back-to-back na something wey neva happun bifor for one of Africa biggest and most respected football nations.
Nigeria don also struggle to make significant impact for di continental and global competitions for age-grade level.
Di NFF now don convey one emergency congress for Abuja to determine dia next steps afta di resignations of Gusau, general secretary Mohammed Sanusi and di 11 other members of di executive committee.
Governance and financial concerns
Beyond results on di pitch, di NFF don face questions ova governance and financial management.
Particular attention don focus on one 17bn naira ($12.66m, £9.31m) intervention fund wey according to tori di Nigerian President Bola Tinubu approve for 2024 to settle outstanding payments and obligations wey di kontri owe national teams.
While dem neva announce any formal findings, sources wey dey familiar wit di ongoing reviews don describe di process as an examination of financial documentation and administrative procedures.
Meanwhile, one fact-finding committee wey di NFF set up afta Nigeria comot from Wafcon 2026 bin highlight some issues for di board level and for di organisation of national teams.
Dia report bin include accuse say NFF board members dey influence team selection and say officials and even coaches dey base call-ups for players on financial gain as opposed to performance.
Calls for sweeping reforms don grow louder in recent months.
Former Nigeria internationals wey include John Obi Mikel, Jay-Jay Okocha and Segun Odegbami don publicly argue say meaningful progress go require a complete break from di cycle of familiar administrators wey don oversee years of underperformance.
And while di resignations create uncertainty, some stakeholders believe say di crisis fit also present opportunity for di changes wey dem don dey wait for long.
But now wey Gusau don resign as NFF president, di kwesion na how di football matter for Nigeria go become better and who go fit make am better.














