Uefa Champions League draw: Who go face who for di league phase?

Bur foto of di Uefa Champions League trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Foto of di Uefa Champions League trophy
Published
Read am in 3 mins

Di draw for di 2026/2027 Uefa Champions League season go happun on Thursday, 27 August, 2026.

Thirty-six team go compete against each oda for di League phase and each Pot get nine team.

Uefa split dis teams into four pots and na from dis pots dem go know who go face who.

From di schedule of how di matches go happun dis season, Matchday one go start from 8 Setember to September 2026.

Di league phase go wrap-up next year, 27 January, 2027

Knockout phase and play-offs go hold between 16 and 17, 23 and 24 February 2027

Di ogbonge final go happun for Madrid, Spain on 5 June, 2027.

All eyes go dey on dis draw sake of say football fans and supporters across di world go wan know which match ticket dem go buy and which club dem go banter di most.

Tok-tok don already start about di clun wey fit win am dis season but na wen dem do draw fans fit know weda dem go fit survive di league phase or not.

Pot 1

Defending Champions and back to back winners Paris Saint Germaine of France dey Pot 1.

Paris (France)

Bayern München (Germany)

Real Madrid (Spain)

Liverpool (England)

Inter (Italy)

Man City (England)

Arsenal (England)

Barcelona (Spain)

Atleti (Spain)

Pot 2

Borrusia Dortmund (Germany)

Roma (Italy)

Sporting CP (Portugal)

Aston Villa (England)

Porto (Portugal)

Man Utd (England)

Club Brugge (Belgium)

Real Betis (Spain)

PSV (Netherlands)

Pot 3

Feyenoord (Netherlands)

Lille (France)

Bodø/Glimt (Norway)

Napoli (Italy)

Leipzig (Germany)

Villarreal (Spain)

Fenerbahçe (Turkiye)

Shakhtar (Ukraine)

Galatasaray (Turkiye)

Pot 4

Slavia Praha (Czech Republic)

Slovan. Bratislava (Slovekia)

Stuttgart (Germany)

AEK Athens (Greece)

LASK (Austria)

Como (Italy)

Lens (France

Viking (Norway)

Sabah (Azerbaijan)

We go dey update dis tori as di live draw dey happun