South Africa go send six wanted Nigerians to US to face trial for Yahoo-Yahoo of more dan $6 million

Wia dis foto come from, Getty Images
South Africa on Friday afternoon go extradite six Nigerians wey dey wanted for di United States ova alleged online romance scam.
Di suspects dey accused of targeting more dan 100 women across di US and allegedly defrauding dem of more dan 100 million rand ($6.2 million).
Di alleged victims include pensioners and business pipo wey dey targeted through sophisticated online relationships.
Investigators allege say members of di 'Black Axe' organised crime group use dis relationships to gain di victims trust bifor dem allegedly tiff dia money.
Dem arrest di six suspects for South Africa for 2021 as part of a major takedown operation wey target di alleged criminal network.
Dem bin dey South Africa while extradition proceedings bin dey on and di suspects dey expected to dey handed over to agents from di FBI and US Secret Service, wey don enta South Africa to facilitate di extradition.
Dem go face di US justice system ova allegations wey dey linked to di international online romance scam.

Wia dis foto come from, FBI
Barely two weeks ago, two Nigerians land America to face prosecution on top accuse say dem dey involved in online sextortion schemes wey link to di death of one American teenager, according to di Federal Bureau of Investigation (FBI).
FBI Director Kash Patel for one post on X say di men be "high-value targets from Nigeria" wey dem extradite to di US following separate investigations.
Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), identify dem as Mudashiru Afeez Olawale wey be 24-year-old and Adebola Festus Adekunle.
Di commission bin hand ova di suspects to authorities afta FBI investigations into di alleged exploitation of minors.
For August 2025, di Federal Bureau of Investigation (FBI) arrest 22 cybercrime suspects, wey dey sexually blackmail and extort US minors.
FBI ontop dia website tok say di arrest na part of "Operation Artemis," one international operation wey dem launch for 2023, to fight di growing threat of sextortion among Nigerian-based sextortion rings.
Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) in collaboration wit FBI conduct di investigation wey lead to di arrest of di suspects involved in di sextortion scheme.
Di agency tok say among di 22 suspects, approximately half of dem dey directly link to victims wey kill demsefs.
Oda times do US don extradite Nigerians from South Africa to face di law include:
For 2021, eight Nigerian men wey dem accuse of one internet dating scam don dey charged to one South African court afta one massive international operation wey involve di FBI and Interpol.
Authorities for di US, wia di investigation originate and most of di alleged victims dey na im arrange for dia extradition.
Dem accuse dem of defrauding more dan 100 victims of almost $7m (£5m) in total over di past decade.
But dis extradition dey show di continued co-operation between South African and international law enforcement agencies to tackle transnational organised crime and ensure say suspects wey dey wanted in oda jurisdictions go face di due legal process.
Further details dey expected to come out following di handover.






