India 'cockroach' protesters call off strike as education minister Pradhan resign

Wia dis foto come from, Getty Images
India Education Minister Dharmendra Pradhan don resign afta weeks of protests on top exam papers wey leaks and testing irregularities.
Di resignation come afta weeks of demonstrations by di Cockroach Janta Party (CJP), one social media banta wey bin as joke bifor e expand into one big campaign wey dey call for accountability and education reforms.
Pradhan bin announce im resignation on X for one post, just hours bifor di third round of toks between di govment and di Cockroach Janta Party (CJP).
"I hold deep respect for di aspirations, sentiments, and rightful expectations of di youth of dis kontri. Realising di dreams of India young generation na di moral resolve of our political and social life," e write.
Prime Minister Narendra Modi don accept Pradhan resignation earlier on Saturday. Di govment neva announce who go replace am as minister.
Protesters don continue to gada for Delhi Jantar Mantar – di main protest site – as many of dem dey celebrate wetin dem see as major victory.
One activist Sonam Wangchuk, wey bin dey di centre of di protest welcome di education minister resignation and call am "victory of democracy".
For one post on X, e hail di CJP, Gen Z and all citizens "for shedding fear and di fear of fear and as dem rise up from evri corner of di nation".
End of Di one wey oda users dey read well well
How di protest take start?

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
E bin start wit one fear wey dey familiar to millions of young Indians: if di examinations wey dey determine dia future no fit dey trusted, wetin dem fit trust?
Wetin bin start as a student-led campaign against alleged exam paper leaks bin turn one of India biggest displays of public dissent in recent years, as thousands of young pipo camp for Delhi and demonstrations spread across di kontri.
Di Cockroach Janta Party (CJP), one youth-led movement wey start out of anger ova repeated examination paper leaks, quickly bicom India biggest student mobilisation in years.
Dem demand for education reforms and di resignation of Education Minister Dharmendra Pradhan.
Tens of thousands of protesters bin turn up on 20 July to take part for di CJP and Wangchuk call to march go di parliament as dem start dia monsoon session.
Di first round of toks between di CJP and govment ministers bin fail to arrive at a consensus.
Pressure begin mount on di Prime Minister Modi afta Monday brutal crackdown on protesters wen police and paramilitary personnel use batons, wooden sticks and tear gas to chase dem away.
Videos of young men and women wey dey bleed profusely afta dem hit dem repeatedly by sticks and batons bin shock India and attract condemnation from all di opposition parties.
Di Congress party bin allege say security forces also use pellet guns on protesters, wey send shockwaves through India.
Police say 118 of dia personnel also dey injured. But major opposition parties, farmer leaders, activists and celebrities largely blame di police and paramilitary forces for triggering di violence.
Reactions follow di resignation of education minister
Rahul Gandhi, di leader of di opposition for parliament, call Pradhan resignation a "major step towards revamping our education system".
"Heartiest congratulations to evri young pesin and student wey take to di streets and stand firm to protect democracy, di constitution, and dia own future," e write for X.
Gandhi say make di Prime Minister Narendra Modi apologise to di students and make di govment take action against dos wey dey responsible for violence against protesters.
Di Bharatiya Janata Party (BJP) national president Nitin Nabin tok say Pradhan decision to step down show di "highest standards of integrity and selfless service in public life".
Wetin be di Cockroach Janta Party?

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Di CJP bin start as one of India biggest youth protest movements, even though e no be political party.
Dem form di group afta di chief justice of India compare some unemployed young pipo to "cockroaches".
E later say im bin dey refer to pipo wey get "fake and bogus degrees", but by then, di term don get a life on its own.
Many young pipo wey dey frustrated by rising unemployment and irregularities for competitive exams - embrace am, dem turn di insect into one symbol of defiance and resilience.
Led by Abhijeet Dipke, di CJP bin campaign for reforms to India education system, greater accountability ova exam paper leaks plus di resignation of Pradhan.
Di movement quickly gain a huge following online and later draw tens of thousands to protesters for di capital.
Hours afta Pradhan resign on Saturday following weeks of protests ova exam paper leaks and testing irregularities, di CJP call of dia agitation, dem say di govment don accept dia demands.
CJP tok-tok pesi Saurav Das say di govment don accept all of di group demands, wey include:
- Di resignation of Education Minister Dharmendra Pradhan
- 10m rupees (£77,737; $103,554) in compensation for di families of pipo wey allegedly die suicide afta exam paper leak
- and no legal action against dos wey join di protests.
As e dey tok for one press conference, Das say di group dey withdraw from di protest "in good faith" and add say dem don share di draft of dia written guarantee wit di govment.
"Dem don accept all our demands. We ask di protestors to peacefully withdraw di protest wit immediate effect," CJP tok-tok pesin Ashutosh Ranka tok.
For di centre na activist Sonam Wangchuk, wey lost 11kg (24lb) during one 26-day hunger strike in support of di movement bifor e end im fast on Thursday.















