Nigerian military rescue retired Major General Rabe Abubakar wife wey gunmen kidnap

Late retired Major General Rabe Abubakar

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Published
Read am in 4 mins

Di Nigerian military don rescue di wife of retired Major General Rabe Abubakar, wey bin die last weekend for kidnappers den.

Di General daughter, Bilikisu Rabe Abubakar confam her mama release to di BBC.

Inside one statement on Monday by Major General Samaila Uba wey be di Director of Defence Information, di military say Amina Abubakar regain freedom afta "intensified search-and-rescue efforts".

Armed gangs bin kidnap di retired general and im wife several weeks ago for north-western Katsina State.

"During sustained offensive operations and pressure mounted on di criminal elements, troops bin make contact wit di bandits for Tunga Village, wey lead to successful recovery of Mrs Abubakar," di military tok.

Di military also say di kidnappers shoot Mrs Abubakar during di operation bifor dem abandon her and run as troops bin advance.

Dem evacuate her to one military hospital and she dey receive treatment, di statement add.

"Di leadership of di Armed Forces of Nigeria remain committed to ensure her full recovery and wey dey provide all necessary support to her family during dis difficult period," di military tok.

Dem add say troops go continue ongoing operations to track down and neutralise di perpetrators, and intensify efforts terrorists go be tin of di past for Nigeria.

Di rescue dey come days afta di burial of Major General Abubakar, wey happun on Saturday afta authorities announce say e bin die for captivity.

Officials say di retired officer kpai for captivity from health complications wey dey linked to diabetes and hypertension.

Bilikisu wey tok to BBC afta her papa death say di family dey go through unbearable pain.

She say dem bury her papa on di day e die according to Islamic rites.

President Bola Tinubu bin express shock sake of di general death and describe am as reminder of di threat posed by armed criminal groups.

Di Nigerian president bin promise say authorities go intensify efforts to rescue di late Major General wife.

Kidnapping for ransom na major security challenge for parts of Nigeria, particularly for di north. Katsina dey among several north-western states wey dey affected by heavily armed kidnapping gangs.

Meanwhile, BBC News Pidgin bin earlier report say sojas of Joint Task Force North West Operation Fansan Yamma (JTF NW OPFY) say dem don begin one deliberate offensive operation, wey di code name na 'Operation CLEAN SWEEP III'.

Di operation dey target terrorist and bandit wey dey operate within Matazu Local Govment Area plus oda neighbouring communities for Katsina State.

According to one statement wey di Media Information Officer of JTF North West Operation Fansan Yamma, Lieutenant Colonel Aliyu Danja issue on Monday, dem launch di operation afta di incident wey lead to di death of retired Major General Rabe Abubakar.

E say di aim of di operation na to locate and kpai di pipo wey carry out di kidnapping, to dismantle criminal networks and restore security within di affected communities.

Di statement add say since di operation start on 14 June, sojas don carry out aggressive fighting patrols, intelligence-led raids, cordon-and-search operations and clearance missions across identified criminal hideouts and suspected terrorist enclaves within di Joint Operations Area (JOA).

"Sojas carry out clearance operations on identified terrorist hideouts for Adua, Nasarawa and Karaduwa areas, wia dem search several criminal hideouts. During di operations, dem discova and destroy di terrorists life-support structures and logistics bases dem see within di area," di statement tok.