Satellite images of wetin Nepal look like bifor and afta as number of missing pipo rise to 4,247

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Paul Brown and Adam Durbin
- Role, BBC Verify
- Published
- Read am in 5 mins
Di number of pipo wey dey miss for Nepal don rise as rescue efforts enta di sixth day.
Di number now dey stand at 4,247, according to di kontri National Disaster Risk Reduction and Management Authority - e go up from 2,502.
Di missing pipo include 3,655 Nepali citizens and 592 foreigners.
Among di pipo wey dey miss na 933 hydropower workers, 102 Nepali soldiers, police and customs officers.
Dem dey find dozens of body evri day as Nepal confam say di death toll don rise to 903 pipo, up from 781 on Sunday.
For Tibet, di death toll currently stand at 16, according to Chinese state media, as 546 pipo still dey miss.
Satellite images reveal di scale of flood destruction for Nepal villages
New satellite images don reveal di scale of di destruction along Nepal Trishuli River caused by Wednesday deadly flash flood, wey glacier collapse trigger.
Bifor-and-afta images show how sections of di valley, wia plenty floodwater and debris rush pass, destroy villages, bridges and hydroelectric power stations.
Hundreds of pipo don die and thousands more dey miss, Nepalese officials say.
Among di worst-hit locations wey BBC Verify review na one important Nepal-Tibet border crossing, wey floodwater rush enta and camera capture.
Di satellite images from US-based intelligence firm Vantor show say di site don almost completely wash away.
One shocking CCTV footage show di moment di floodwater sweep ova buildings as pipo try escape.
Damage and mud fit dey seen more dan 2.5km (1.5 miles) upstream, reaching 100m (330 ft) above di area wey e first hit.
Few miles further south na di village of Timure, wey don now largely disappear.
Di walls of di valley for dis point dey steep, e reach up to 50m above di water line.
Di image show say most of di houses wey dey on dis slope don disappear or don cover wit mud.
Anoda 10km (eight miles) downstream, wia di Trishuli River dey wind through Syapru Besi, satellite images now show di village covered wit mud, rock and oda debris.
Houses and oda structures don disappear, including bridges and one hydroelectric power station.
One of di bigger villages wey di full force of di flood hit na Trishuli, wia some of di earliest verified footage of di disaster come from. One satellite image of di town and di agricultural land around am, wey dey about 45km (28 miles) downstream from di border, show say one whole neighbourhood don almost completely wash away.
Verified videos of di town show one bridge collapsing as di river dey surge forward. For di same moment from ground level, footage wey dem film from inside one bus show pipo dey cry out in distress and dey try escape as dem see di water wey rush down di river.
Oda dramatic videos show pipo dey shelte inside one house, peeping over di edge of one balcony as dem watch floodwater rush wash away almost evritin around dem, pushing large metal debris and one vehicle towards di building.
Somehow, di house remain intact and survivors fit dey seen for anoda verified video standing surrounded by mud afta di floodwater recede.
Images from satellite provider Planet Labs wey dem release today don also provide clearer view of di origin of di disaster at di collapsed glacier, di moment wey verified drone video capture.
Di satellite image show say one enormous part of di glacier don fall away, carving one huge path of rock and debris where water rush through di valley.
For di base of di landslide, trees and oda vegetation don strip away at a height of more dan 300m above di riverbed.

Dis destructive path kontinu westwards togeda wit di swollen river, bifor e head southwards.
Satellite images also show di formation of one barrier lake at di base of di landslide’s path, wey Chinese authorities don warn say e pose major risk of more flooding and don make rescue efforts difficult.
Dr Argha Banerjee, a glaciologist at di Indian Institute of Science Education and Research, tell BBC Verify say e no possible to determine from di images how stable di barrier be or how likely di lake dey to drain suddenly.
But e say di surface area no show any significant increase between Wednesday and Thursday, despite water continuing to flow into di lake.
Dr Banerjee say one visible drainage channel dey dia, wey suggest say some water already dey escape downstream, adding say di volume “no dey alarmingly large” and e appear say e don stabilise.
Di extent of di damage on di Tibetan side of di border remain unclear. Na one strictly controlled region wey China annexed for di 1950s, where foreign media access dey heavily restricted. BBC Verify don so far fail to find verifiable footage from di area.
Di satellite images - wey only provide an initial glimpse into di damage from di flood - Vantor publish am as part of its Open Data Program to help authorities establish wia dem suppose focus dia efforts to locate di pipo wey miss, rescue survivors and recover di dead.











