Wetin to know about Joshua vs Fury fight wey many pipo don dey expect

Wia dis foto come from, Thananuwat Srirasant/Getty Images, AFP via Getty Images
Anthony Joshua and Tyson Fury don lock in to bring one of di biggest British boxing matches wey fans don dey expect for long.
Dis na as di former world heavyweight campion Fury announce am for im Instagram page.
E tok say di fight go happun for Madison Square Garden for New York City even though dem neva announce any date for di fight.
"What a fight Fury vs AJ, di land of opportunity. Dis kain weekend na one wey di lads dem fit piss off NYSC. Iconic. Not long now guy," Fury write for Instagram.
Even though di date neva dey announced, tori be say e go hold for November afta both of dem bin sign contract wit Turki Alalshikh, wey be di Saudi Arabia General Entertainment Authority chairman.
However, fans don dey enta di boxers well-well say e no make sense say dem go box all British fight for di US and not somwia like Wembly Stadium for di United KIngdom.
To add more pepper for inside di mata, even di Mayor of London, Sadiq Khan say e really wan host am for Wembley Stadium and dey ask make di promoters contact am.
E add say, "Anthony Joshua and Tyson Fury na two ogbonge British boxers. Both don be world champions. Dem both dey see and love di fans for dis kontri wey don support dem for dia careers both amateur and professional.
"Wembley don host plenti ogbonge events wey include fights wey include Tyson and Anthony. We, di fans wan see dem box live for London."
Tyson Fury wey be 38 years old don win 36 professional matches for im time. In fact, di only two matches wey im don lose na against di same pesin, Oleksandr Usyk for 2024.
Im bin retire from boxing for December 2024 afta im lose di match to Usyk wia three of di four major titles bin dey on di line. Although e later do about turn for im retirement for January.

Wia dis foto come from, Mark Robinson/Getty Images
Dis no be di first time wey dem don try to run dis link up between two of di biggest British boxers.
For 2021, tins fall apart as Joshua and Fury bin no dey able to agree on terms of di fight and di mata kon even get k-leg afta US judge bin rule say Fury go need to face Deontay WIlder for trilogy fight instead.
For July dis year, Fury make one Polish fighter Mariusz Wach to retire afta e beat am for di Max Muay Thai Stadium for Pattaya, Thailand.
For dat same July, Joshua bin fight im first fight since im bin dey di car accident for Nigeria wey claim two of im close friends lives.
E bin fight wit Albanian Kristian Prenga for 25 July and bin win against am for di second round of di fight. Dis na even afta di former kickboxer bin knock Joshua down two times in di first 20 seconds.









