You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Three years afta di civil war: Wetin dey happun for Sudan?
As Sudan civil war don last for three years, di kontri still dey suffer from one of di worst humanitarian crises for di world.
Millions of displaced pipo for Sudan still dey face hunger, abuse and diseases even as di kontri healthcare system don collapse and e dey difficult for dem to access medical treatment.
Di Sudan civil war wey don last for three years bin start on 15 April, 2023, afta di power struggle between Sudanese Armed Forces (Saf) and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF).
Saf and RSF agree to work togeda to lead military coup for October 2021, to overthrow di transitional govment wey come into power afta dem remove di longtime ruler Omar al-Bashir for 2019.
Di fall of el-Fasher na one of di most brutal chapter of di civil war wey start for capital Khartoum for 2023.
E quick spread to oda parts of di kontri and e dey brutal for di western region of Darfur, wey be RSF stronghold, wia el-Fasher dey.
Di fighting don lead to wetin be de-facto division between territory wey army and paramilitaries dey hold.
Millions of Sudanese citizens don scata, some dey outside di kontri, forced from dia homes in di midst of di world worst humanitarian crisis.
Wetin Amnesty tok about Sudan Civil War?
One Tuesday, Amnesty International bin issue one press statement wia dem ask International communities make dem increase humanitarian funding and ensure safe unrestricted access to di aid, particularly to survivors of violence.
Amnesty International don call on di international community, including African Union, di European Union and di UN, make dem prioritise accountability for di ongoing crimes wey dey happun under international law and oda serious human rights violations for Sudan.
"Di international community gatz also secure more funding and pressure di parties wey dey fight to ensure say dem allow humanitarian access wey go fit deliver healthcare services to civilians, including di survivors of sexual violence," di statement tok.
According to Amnesty, since di war start, RSF and Saf don dey rape, gang-rape, torture and violently kill civilians, "all dis don amount to war crimes and crimes against humanity".
Amnesty tok say di RSF and dia allied forces deliberately kill civilians, destroy dia properties and hold some of dem hostages, afta di attack wey happun for April 2025 for Zamzam, Sudan North Darfur.
Di human rights organisation tok say RSF fighters burn houses, business and critical civilian infrastructure and e don displace ova 400,000 pipo.
BBC reporter turn on im phone afta three years
Soon afta Mohamed Suleiman enta telecoms office for di coastal city of Port Sudan on 13 January, e start to cry.
E neva hear im phone ring for most of Sudan civil war, wey bin start three years ago afta di struggle for power between di army and dia ally, di Rapid Support Forces (RSF) paramilitary group.
Di journalist and academic don reach Port Sudan afta dem trap am for di western city el-Fasher, wey cut off from di world wit communication blackout and im no fit fully explain di horrors wey e witness.
"I dey vex becos pipo dey tok for dia phone (inside di office)," e tell BBC.
"Throughout di past three years, my phone dey silent. Afta I put di SIM card, my tears dey start to flow."
Wen im phone finally dey active, e dey ping wit three years messages, an inventory of loss: news of colleagues wey don die, friends dey ask weda e still dey alive.
"Some days ago, one pesin call me say im tink say I don die," e tok. "Some pipo don tell am say I dey Port Sudan, so e call me, but e no believe (na me) until I call am back wit video, den im break down for tears."
Suleiman tok say di silence dey almost as deadly as di violence.
E describe am as "suffocating feeling becos I dey watch systematic killings through drone strikes and bombs or deadly killing through di tight siege" wey RSF impose on el-Fasher for 18 months.
And wen di RSF finally take ova di city for October last year, "E be like di Day of Judgment for Earth," e tok.
"We witness di Day of Judgment for Earth."
Diplomatic efforts by di US to end di war don fail as both sides dey get support from regional powers wey dey enable dem continue di fight.
Mohamed Suleiman tori na one of di worst tins for di war, and e show how dem fit strip food, shelter, life, and even identity from innocent pipo.
Civilians for el-Fasher dey in-between di fight wey dey happun between RSF and local armed groups wey dey help di army defend di city. As di paramilitaries dey tighten dia grip, one UN-backed food monitor don declare famine conditions.
Di relentless daily trauma of death and hunger don burst into apocalyptic scenes as pipo dey run wen RSF draw close.
"We see dead pikin for street," Suleiman tok.
"We see women dey cry from extreme hunger and thirst, too weak to carry dia pikin, so dem just leave dem for road."
Dem get "pipo we know by name and we know dia fathers, but we no fit provide anytin for dem."
"No food, no water, no first aid to save dem, or to carry dem go wit you. You no fit do anytin. So you go just step ova dem, jump ova dem, dey cry, and continue to waka," Suleiman tok.
Mohamed Suleiman dey try rebuild im life for Port Sudan
Suleiman dey pray again wen e land for Port Sudan, di headquarters of di military-backed govment during di war, for January dis year afta di journey wey pass two months wey carry am through Chad.
"As soon as I arrive for Port Sudan, I prostrate for ground for di airport and I begin to cry intensely becos I no fit imagine say I go reach safe haven," e tok.
Although Suleiman don reach safety, im don lose all im identification documents. To get dem back make e begin feel like pesin again, but na anoda fight wit bureaucracy.
"I spend 22 days going around offices," e tok. "Di last tin wey dem tell me wey make me regret be say make I bring my mama. And make I bring number of witnesses. Thank God say I get witnesses and I bring dem, but wetin go happun to pesin wey come out from war and e no get one?"
Di special procedures wey dem announce for exceptional cases na just tok, Suleiman tok, e call on di state to give identification documents to pipo wey dey come out from war zones witout charge.
Suleiman don reconnect to di world, but e tok say afta wetin e don see and experience, e feel like say di world neva return to am.
"No international law for di world," e tok.
"No United Nations. If dem get human rights organisations, no day go pass for el-Fasher wia pipo no dey die of hunger and thirst, bombed by shells and drones.
"No ceasefire, no medicine, no basic tins wey pipo need to live."
Di world don fail to meet Sudan big humanitarian need - dem hinder am wit di fighting, bureaucratic restriction from both sides, and no money - na only 16.2% of di UN $2.87 bn (£2.13 bn) needs assessment for di year 2026 dem don meet so far.
One peace plan wey di so-called Quad nations - America and di kontris wey dey most involved for di war; Saudi Arabia, di UAE, and Egypt - put forward last September don go nowia.
In di meantime, di US envoy Massad Boulos dey try get agreement on at least humanitarian ceasefire.
And dem don fail to stop di fighting too.
Di Sudan wey Mohamed Suleiman don experience na different kontri - e don divide, and di pipo don scata. But e tok say to tell dia tori dey give am sense of purpose.
"Na events wey happun wey nobodi dey tok about, and di memory go remain only wit us... until we die, we go carry di truth to correct di situation for di next generation, so dem go fit live wit dignity and honour for dia homeland."