All you need sabi about 2026 UTME examination as Nigeria police update candidates on security

Read am in 5 mins

Di Nigeria Police Force don tok say rumours wey dey spread up and down about safety of some centres for North Central Nigeria ahead of di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) examination no be true.

UTME 2026 go start on Thursday 16 April and di Nigeria police say dem no dey act on rumours. Dem add say dem don take note of di concerns wey di public raise about safety, education and future of di children and wards.

For statement on top dia X account, di Nigeria police say dem don take some steps to make sure say security dey.

"We don deploy extra security for examination centres nationwide, both overtly and covertly, to prevent any untoward incidents. Dis includes routine patrols, perimeter checks, and sharp-sharp response teams wey position for strategic places," di statement tok.

Nigeria police say dem dey collabo wit oda sister security agencies to monitor and address potential threats sharp-sharp.

Dis dey come afta di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) for Nigeria notify candidates wey wan write di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) 2026 exam dis week say di arrival time for di exam don move from 6:30am to 7am for session one.

For notice on dia verified X handle on Monday, Jamb say di start time for di session one of di exam remain 8:30am and end time remain 10:30am. Dem say candidates no need to reprint dia exam slip for dis purpose.

Session two arrival time na 9am, start time na 11am and end time na 1pm.

Session three arrival time na 11am, start time na 1:30pm and end time na 3:30pm.

Session four arrival time na 2:00pm, start time na 4pm, and end time na 6pm.

Di announcement dey come afta some candidates and dia parents begin query why Jamb go fix dia arrival time to 6:30am, say e dey too early for young school kids to dey move around by dat time.

Last week, Jamb bin ask candidates wey register for di 2026 UTME exams make dem start to dey print dia examination notification slips bifor dem come write di exam wey go start on 16 April until 25 April.

Inside one statement wey di tok-tok pesin Fabian Benjamin sign, e tok say dis slips contain candidates examination date, venue, and time.

Di statement tok say di examination go happun for several days, so e dey necessary make candidates confam dia individual schedules.

"Candidates dey strongly advised to print dia exam slips in order to confam dia examination date, venue, and time, as dis exercise go happun for several days," di board tok.

Jamb also warn candidates and examination centre operators against examination malpractice.

"Dis year examination features get enhance security measures wey go fit stop all forms of malpractice," di board tok.

How to print your exam slip

Di Board don urge candidates make dem print dia slips early and familiarise demsefs wit dia examination centres to avoid any last-minute challenges.

Jamb add say dem don assign each candidate to specific schedule on di slip, wey go allow di candidates arrive for di centre bifor di examination time. Dis go allow di candidates to do proper screening and accreditation bifor dem start di examination.

"Attention 2026 UTME Candidates: Dis na to notify you say Examination Slip Printing don dey available now. Di slip contain detail of di venue, date and time of your examination and give you access to di examination hall," Jamb tok for dia website.

If you wan print di exam slip, candidates go need visit di Jamb website and click on 2026 UTME Slip Printing.

Den candidates go need input dia details such as dia contact, email address or dia registration number.

Examination malpractice

For dis year Jamb examination, na ova 2.2 million candidates go sit for di Computer-Based Test wey go hold for 989 centres across di kontri.

On Monday, Jamb warn all dia accredited centres nationwide say any facility wey no get surveillance camera wey go dey visible on dia central monitoring system go face sanctions.

Jamb say dem no go pay for di services of dis centres and even invalidate di centre for any examination activities.

"All centres wey dey participate for di processes, particularly registration and examination gatz ensure say dia surveillance cameras dey accessible and viewable from di Board control room for di headquarters," di Board tok.

Di examination body also warn say during examination, any centre wey suddenly become unviewable from di monitoring desk go face immediate delisting.

Di Board tok say e dey important make exams centres enable real-time monitoring. Dem say dis go allow di Board detect irregularities during registration and examinations and take prompt corrective action.

Jamb say dem fit cancel all di candidates wey dey registered for dis centres wey no comply.

Di Board also note say dem don already delist some centres based on say dem no dey visible for dia central monitoring system.

Recently, Jamb don introduce some reforms, like computer-based testing and centralised oversight systems, to reduce malpractice and improve efficiency.

Last year exam ova 150 centres no dey visible from di control room for Jamb headquarters, leading to mass failure wen di result bin first come out bifor di Board later make corrections.

For 2025, Jamb sue 94 candidates ova alleged malpractices and fake certificates. Di examination Board dey put measures in place to ensure say di scores wey candidates use for dia tertiary institutions na di real grade.