Nigeria major political parties timetables for primaries ahead of 2027 general elections

APC and ADC

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFP via Getty Images, ADC

Read am in 4 mins

Three major political parties for Nigeria don drop timetable for wen dem dey plan to run dia own primaries ahead of di general elections for 2027.

Di ruling All Progressive Congress (APC) bin release dia revised timetable and schedule of activities wia dem bin adjust timeline wey dem go take do screening, primaries, appeals and related internal party processes.

Dem do dis one for announcement wia dem share di account numbers for pipo wey wan buy expression of interest and nomination forms.

Dem tok say di reasons behind di revision of di timetable na sake of di May Day public holiday.

Meanwhile, di opposition wey don enta many court kasala recently, di African Democratic Congress (ADC) don also drop timetable for dia primary elections dis year.

Inside one statement by di party National Publicity Secretary Bolaji Abdullahi, ADC say di timetable dey reflect di party commitment, internal democracy, orderliness and full compliance wit electoral guidelines.

On di mata on weda dem go fit field any candidates for di next election, dem bin don tok for statement say "legal impediment no dey to our participation for di 2027 elections and any suggestions against dat na move to mislead kontri pipo and kill di morale around our party."

ADC also claim say dem be di "primary opposition platform for Nigeria and we dey take dat responsibility seriously."

Labour Party na di latest to release dia own timetable.

ADC timetable for primaries

Sale of nomination forms - May 5 to May 10, 2026

Submission of completed forms - May 11 to May 13, 2026

Screening of aspirants - May 14 to May 15, 2026

Publication of screening results - May 17, 2026

Appeals on results - May 18 and May 19, 2026

Party Primaries:

  • State Houses of Assembly, House of Representatives, and Senate: May 21, 2026
  • Govnorship: May 22, 2026
  • Presidential: May 25, 2026

National Executive Committee meeting - May 26, 2026

Special National Convention - May 27, 2026

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

APC revised primaries timetable

Sale of forms - May 2 to May 4, 2026

Submission of completed forms and accompanying documents - May 4 to May 5, 2026

Screening of aspirants - May 6 to May 8, 2026

Presidential screening - May 9, 2026

Publication of screening results - May 11, 2026

Screening appeals - May 12 to May 13, 2026

Party Primaries

  • House of Representatives - May 15, 2026
  • Senate - May 18, 2026
  • State House of Assembly - May 20, 2026
  • Govnorship - May 23, 2026
  • Presidential - May 25, 2026
Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Labour Party timetable for primaries

Sale of nomination forms: May 6 to May 16, 2026

Submission of completed forms: May 17 to May 18, 2006

Screening of aspirants:

  • House of Assembly and Governorship: May 20 .
  • National Assembly and Presidential: May 22
  • Publication of Screening Results: May 2026.

Publication of screening results: May 23

Appeals/Petitions:

  • House of Assembly and Governorship: May 24
  • National Assembly and Presidential: May 25
  • Publication of Final List of Cleared Aspirants: May 26

Party Primaries:

  • House of Assembly and Governorship – May 27
  • National Assembly and Presidential – May 29

Also, di Labour party peg di price of dia form for pipo wey wan run for di office of di president, for 50 million naira, govnorship seat na 25 million, senatorial seat na 10 million, House of Reps na five million while State House of Assembly na three million naira.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Dis dey come afta di Independent National Electoral Commission reveal dia timetable for di 2027 general elections.

Di time table give political parties between April 23 and May 30 to conduct dia primaries, and resolve all disputes wey fit come up within dat time.

Election campaigns for presidential and National Assembly elections go start for August 19 while campaigns for govnorship and state House of Assembly go begin on September 9.