You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Godzilla vs Kong actress Kaylee Hottle die at age 18
- Author, Naomi Clarke
- Role, BBC Newsbeat
- Published
- Read am in 3 mins
US actress Kaylee Hottle, wey be ogbonge star for di Godzilla vs Kong movie series, don die at age 18.
Di actress die for car crash, according to how her family announce di report of her death.
Hottle, wey no dey hear, bin act as one young orphan girl wey dem dey call Jia for di 2021 blockbuster film. She come play di same role again for di 2024 sequel, Godzilla x Kong: The New Empire
Her father, Joshua Hottle, wey post video statement through Facebook use American Sign Language to confam details of her death.
Police officers for Frederick, Maryland, tok say dem believe say di motor dey speed too much, and na im cause di one-vehicle accident wey happun on Tuesday morning
Di Texas School for di Deaf, wia Hottle bin study, also share di tori, dem write say wit "profound sadness".
"Our hearts dey wit Kaylee family, friends, classmates, and everyone wey sabi and love her during dis incredibly difficult time," dem tok for one statement wey dem post for Instagram.
Dem also say make everyone respect di privacy of her family and make dem no tok wetin dem no know about di car crash.
Warner Bros, wey dey distribute popular monster feem, pay tribute to di actress alongside foto of her for one post on X.
Frederick County Sheriff Office say dem call deputies to di scene of di accident for Ijamsville at about 02:50 local time.
Police say dem take 19-year-old driver go hospital for treatment for "non life-threatening" injuries, while second passenger say im no need help for di scene.
Hottle appear for Godzilla vs Kong alongside Hollywood stars wey include Alexander Skarsgard, Millie Bobby Brown and Rebecca Hall.
Her role for di 2024 sequel earn her Saturn Award nomination for best younger performer for feem.
Profile of Kaylee Hottle
Dem born Kaylee Hottle for di United States. She dey deaf and dey communicate well wit sign language.
Her papa and mama also dey communicate wit sign language.
Kaylee attend di Texas School for di Deaf for Texas. She dey known for her participation in field and track spots events and oda activities.
Her acting career start wit commercials wia some feem directors find her.
She act for feems like Godzilla vs. Kong, Magnum P.I. and also di Godzilla x Kong: The New Empire wey dem release for 2024.
Dem nominate her for di Saturn Award for Best Performance by Younger Actor for di 52nd Saturn Awards.