Wetin dey ginger kasala for France as protests turn to looting and violence

Wia dis foto come from, Reuters
France wake up on Sunday to see plenty destruction afta one day of riots and demonstrations. Shop windows don scatter, many cars don burn finish, bicycles destroyed, and plenty broken glass and debris full di streets and pavements of Paris.
Police arrest about 1800 pipo on Saturday, as some 550,000 demonstrators enta streets to protests.
Dem dey protest against rising fuel prices, di cost of living and deteriorating public services, wey include schools.
Some group of rioters, wey wear black and wear masks and balaclavas, also come out for Paris, Marseille plus oda towns and cities, some of dem burn cars and buildings.
Wia protests dey happun for France

Wia dis foto come from, Kiran RIDLEY / AFP via Getty Images
Widespread looting bin take place across di cities of Paris, Marseille and Lille, plus oda areas.
For Paris, protesters bin clash wit riot police, and di police use tear gas and water cannon to chase di crowds.
During di day, some group of protesters bin lit fires for di street and burn vehicles. At least one restaurant catch fire, and BBC see as fight break out among groups.
BBC also see as riot police use force on one crowd for central Paris and hit several pipo wit batons.
Further south in Marseille, protesters use force enta di city hall using one metal fence as battering ram.
For Lill, dem set one McDonalds on fire, police tok, plus one Apple store for di city, dem break enta and loot di store.
Prime Minister Sébastien Lecornu tok say150 police officers injure for di unrest.
On Sunday morning for Paris, residents bin survey di damage, wey include smashed glass frontages of designer stores including Ralph Lauren, Gucci and Versace.
Shopkeepers bin dey out early wit brooms, dey pick up large pieces of glass as dem start to clean-up. Rubbish trucks bin work dia way down some of di larger streets to clear some of di debris.
Dem use paint write some tins for di shops like, "tax di rich" and "eat di rich."
BBC visit one clothes shop close to di Place de la République wey dem don ransack, as piles of clothes and furniture scata for di floor of di shop.
For Lyon, Mayor Grégory Doucet tok say burning of di city tourist office na "big tragedy". As e dey tok to BFMTV, e say, "E dey pain us well well becos na one very important and popular historic building for di city."
For di French capital, di main march appear to dey largely peaceful during di afternoon. One group of young pipo bin tell BBC say dem be "pacifists" wey "just dey try to make things change, but nothing dey move".
Local police say "hostile individuals" dey prevent firefighters from safely tackling di fire.
Fire crews also battle one fire for Limoges town hall, wey cause part of di building to collapse. Local officials tok say most part of di town hall don burn.
"One wild horde" don "deliberately" set fire to di 143-year-old building, Maurice Barate, di prefect for di Haute-Vienne department tok.
Who be di protesters and why dem dey protest

Wia dis foto come from, Reuters
Student protests for France don see hundreds of thousands enta streets since di protest start late last month.
Protesters dey demand for additional investment for dia schools, as dem condemn di lack of teachers and staff, overcrowded classrooms and run-down buildings.
For di past few weeks, hundreds of thousands of students don dey protest bicos teachers and school workers no dey enough, and facilities for many secondary schools don spoil well well.
Trade union members and oda protest groups join support di students. One of di groups na di Yellow Vest (Gilets Jaunes) movement, wey bicom popular afta dem protest against di high cost of living for France from 2018 and continue di protest for more than one year. Na one of the longest protest movements for French history.
Di French interior ministry condemn wetin dem call "targeted act of violence" and dem accuse some protesters say dem dey try to loot and dem dey also attack police.
BBC Correspondent for Paris report say while some protesters for di capital dey ready to cause kasala, tori be say di pipo wey dey do di main march dey peaceful.
One group of young pipo tell di say BBC dem be "pacifists" wey "just dey try to change tins"
French President Emmanuel Macron don beg dem to "calm" down as e call on demonstrators to show "respect for pipo and property"
Videos show as pipo dey throw fire for di capital, Paris and for Marseille, fotos show as police dey spray tear gas to chase away protestesters.
One high school pikin tell Reuters say, "na joinbodi to make demands and social classes".
Di yellow vests wey be one of di pipo wey dey organize dis protests bin protests against high cost-of-living for ova one year for 2018.
Na dia website bin show wia hundreds of protesters go gada as dem bin dey plan di Saturday protest.
Dem also call farmers, workers, climate marchers and pipo wey don retire to come support di movement.
France bin close ova 500 schools sake of protests.
Wetin cause di violent protests for France?

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Di movement wey bin start nearly two weeks ago for low income Seine-Saint-Denis area of northern Paris don spread around di kontri.
Di weather hot well-well on Thursday and authorities block hundreds of lycées (di place wey 15 to 18 year olds dey finish dia schooling).
Di situation bin beta small on Saturday but na 400 lycées dem bin close so dat dem go fit protect staff and student.
Tori be say universities don begin join di protest.
Di students dey demand for money, more teachers, smaller classes and beta buildings.
Dis protest don cause ogbonge kasala wey lead to di burning of halls for di lycées and many teachers, students and even police pipo don wound.
Wetin authorities don tok

Wia dis foto come from, Reuters
Apart from Macron, oda pipo for govment don chook mouth inside di mata of dis protests.
Dis week, Macron tok-tok pesin comot tok say im dey fear say di "correct" worry wey pipo dey get, political forces wan come kolobi am.
France Prime Minister Sébastien Lecornu bin tok dis week say im dey reason say na France left party La France Insoumise dey use dis students dem dia anger and manipulate am.
E tok on Wednesday say, na dem dey encourage di protests say "members of La France Insoumise dey use di school movement for dia own electoral advantage".
Education Minister Édouard Geffray bin go one school wey dem vandalise to pieces on Thursday, e beg protesters to stop di kasala, as e say na only tok-tok go fit solve di mata.
While France no be stranger to outbreaks of protest and disorder, dis round dey come as di kontri dey enta period of deep political uncertainty.
French President Emmanuel Macron go comot office next year and polls dey suggest say April presidential election fit come down to fight between di leader of di National Rally, Marine Le Pen, and Jean-Luc Mélenchon of di hard-left La France Insoumise party.
Di latter bin follow for di demonstrations for France and dem later accuse di police officers say dem "use violence" on protesters, as dem condemn di looting and arson.
Lecornu tok say im comments dey "dangerous and cynical".
Earlier, e bin say police face "violence of extreme intensity" and some groups bin dey use di protests as "warm-up" for di presidential elections, e add say: "No body go impose dia political agenda through violence."
Le Pen say protesters don voice dia "legitimate demands" and she accuse Mélenchon say na im dey fuel di violence.
Macron don make am clear say: "Dos wey break, attack di prefectures and businesses, and dos wey loot our town halls, go dey face di law and dem go receive punishment."






















