NDC hold special convention to pick presidential candidate ahead of 2027 election

Peter Obi holding certificate

Wia dis foto come from, Peter Obi/X

Published
Read am in 4 mins

Di Nigeria Democratic Congress (NDC) dey hold special convention to announce who dia presidential candidate for di 2027 election go be.

Alreadi, eye dey ontop di party as dem dey expected to officially announce former Anambra State govnor Peter Obi as di party main flag bearer - since im be di only one wey pick nomination form for di president seat.

Di Independent National Electoral Commission (Inec) set 30 May as deadline for parties to submit di names of dia candidates wey go contest di 2027 general election.

NDC announce early Saturday morning say di special convention go hold for Abuja on 30 May 2026, wia dem go affirm dia presidential candidate.

Across di kontri, di NDC dey continue wit di primary elections for di oda aspirants wey dey run for different positions, from House of Representatives to Senatorial and govenorship seats.

Dis elections bin dey fixed for 27 and 28 May, but sake of say di Eid-El-Kabir holidays bin fall inside dose two days, di party say e bin cause logistic challenges for dem.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Peter Obi waving to di crowd during NDC event.

Wia dis foto come from, NigeriaNDCHQ/X

Wetin we call dis foto, Peter Obi dey enta di NDC primary election as di only aspirant wey pick di presidential ticket for di party.

Anybody wey NDC announce as dia presidential candidate go face Bola Tinubu of All Progressives Congress (APC) and Abubakar Atiku of Africa Democratic Congress (ADC).

For di ruling APC, President Bola Ahmed Tinubu emerge di candidate with almost 11 million votes.

For ADC wey be di main opposition join-bodi movement for Nigeria, former Vice President Atiku win di presidential primary election.

Atiku get a total of 1,846,370 votes, to defeat im rivals, former Rivers State govnor Rotimi Amaechi (504,117) and businessman Mohammed Hayatudeen (177,120).

For di Nigeria Democratic Congress (NDC), e don almost sure say na Peter Obi go come out as dia presidential candidate.

Obi bin don already promise say e go do only one tenure if e win, so dat di normal convention of rotating di presidency betwin di north and south go continue.

For Peoples Democratic Party (PDP) wey big internal crisis still dey go on, e neva clear who dia real presidential candidate be.

Di PDP still dey divided into two factions, and di two groups don nominate presidential candidate each.

On Tuesday, 26 May 2027, di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support, nominate one former Senator, Sandy Onor, as dia consensus presidential candidate.

For di event for di PDP national secretariat for Abuja, chairman of dia screening committee, Samuel Ortom, tok say Onor na di outstanding candidate wey dem sure say e go take di party to victory.

Anoda faction of di PDP dey gada too to confam former president Goodluck Jonathan as presidential candidate.

Peter Obi na former govnor of Anambra state for southeastern Nigeria wia im get strong record. E also get active support base for social media.

Im become flagbearer wen Labour Party hold dia convention for Asaba Delta state for di 2023 election wit im vice Yusuf Baba-Ahmed, a former Senator from Kaduna state.

E dey portray im sef as 'Mr Clean' - some tin wey many Nigerian politicians no fit boast about.

Former aspirant himself Professor Pat Utomi step down for Obi wia e also tok say Obi deserve to get chance to govern Nigeria.

Dis na di third time wey di two term govnor go dey ontop presidential ticket as e serve as running mate to Atiku Abubakar of di PDP for 2019 elections, and presidential candidate for 2023.

Obi first comot labour Party to join Adc, bifor e later come go NDC.