How AI-generated voice of Tinubu and edited video of VDM make presidency call for activist prosecution

Man point hand towards di camera, anoda man dey for di side

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/VDM via Facebook

Published
Read am in 4 mins

"VDM need to face di weight of di law say e dey share fake audio of President Tinubu", dis na wetin Nigerian Presidency write about activist and social media influencer Martins Vincent Otse, popularly known as Very Dark Man afta di circulation of one AI-generated audio wey pesin place on VDM video.

Na on Wednesday 27 May, 2026 di special Adviser to President Bola Tinubu on Information and Strategy, Bayo Onanuga, bin quote one X handle wey post di video.

Pesin bin add AI-generated voice note wey dem use President Tinubu voice do to VDM video.

According to our search, VDM on Monday 25 May, 2026, post video of imsef on im Instagram page wia e sidon, e play di video of anoda social influencer King Mitchy wia she dey refer to am and im necklace.

Afta King Mitchy video, VDM kon play di video of President Tinubu wia e promise say Nigerians go get electricity, if not, make dem no vote am in di second time.

For di intro of di video, VDM say: "You see dis next video wey I wan play, I go come know weda dem don cook your mind, una wey wan support Bola Tinubu."

E kon play President Tinubu video.

But pesin kon pick dat same VDM video, put AI-generated audio of Oga Tinubu, to make am look like say VDM dey push di audio.

Di AI-generated audio of President Tinubu say: "Dem dey try comot me from dis position, dat no possible. Mind you, I go win dis election, I no care wetin dey happun, Nigeria deserve am becos wen I dey run as President, dem no want me, but now all of a sudden, dem want make I rescue dem from insecurity."

For inside di AI-generated audio, di voice also say im "call Peter Obi to step down but e refuse" and kon add say im go "make sure say di insecurity affect di southeast more".

Dis na wetin Onanuga write about di doctored video: "Dis VDM need to face di weight of di law as e dey share fake audio of President Tinubu. Dis na clear case of abuse of di social media platform."

Screenshots of VDM

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto, Di screenshot for di left na di original video from VDM Instagram page, while di one on di right na di edited one wey Onanuga comment on
Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di problems wit AI

For time wey Nigeria dey face serious insecurity problem from schoolkidnapping to worshippers abduction and farmers attack, dat edited video of President Tinubu voice wey pesin place ontop VDM video fit cause security and ethnic kasala.

Dis na wetin several AI sabi pipo don dey warn about say na one of di dangers of AI usage wey no dey regulated.

Di Centre for AI Safety say e get different bad scenarios wey fit happun from di usage of AI.

Dem say AIs fit dey weaponised - for example, e fit dey used to clone pesin voice or even impersonate.

Dem add say AI-generated misinformation fit destabilise society and "undermine collective decision-making".

For Europe, di EU dey create Artificial Intelligence Act to protect dia citizens rights by regulating how dem go fit use AI.

Nigeria as a kontri neva dey strong on AI laws wey fit protect citizens from impersonation of face, voice and oda areas.

Who be VDM

Martins Vincent Otse na social media influencer, wey also regard imsef as online police.

Very Dark Man na activist wey dey controversial for di Nigeria social media space.

Im dey known for confronting govment officials, corruption and pipo wey dey go against di law.

Sake of im activism, im don chop arrest plenti times and get pending court cases for many Nigerian courts.