Who be Puleng Dimpane wey South Africa President Ramaphosa appoint as acting national police commissioner

Wia dis foto come from, @GovernmentZA
South Africa President Cyril Ramaphosa don appoint Lieutenant General Puleng Dimpane as di Acting National Police Commissioner.
Dis na afta di president place Fannie Masemola on precautionary suspension, pending di finalisation of di case e dey face.
Masemola dey face four charges under di Public Finances Management Act.
Earlier dis week, Masemola bin appear for court ova im role in di contract wey dem give to Vusimuzi "Cat" Matlala's Medicare24.
On Thursday, Ramaphosa appoint Puleng Dimpane as di Acting National Police commissioner wen e dey address tori pipo for Pretoria.
Ramaphosa tok say im govment don take step to stop corruption among senior officers and becos of di seriousness of di charges against Masemola, e go dey on "precautionary suspension pending di conclusion of di case."
E add say dia effort na to ensure say law enforcement agencies go fit act rightly witout any fear, favours and prejudice
Di president tok say to ensure say leadership run smoothly for di South African Police Force, im don appoint Puleng Dimpane to replace Masemola.
"South African Police Service national police commissioner Fannie Masemola dey face charges of contravention on di public finance management act," Ramaphosa tok.
"In consideration of di seriousness of dis charges and di critical role di national police commissioner dey play in leading di fight against crime, I don agree wit General Masemola say e go dey on precautionary suspension pending di conclusion of di case.
"To ensure stability and continuity for di South African Police Force, I don appoint Lieutenant General Puleng Dimpane as di Acting National Police Commissioner," di president tok.
While, addressing tori pipo, Ramaphosa tok say Dimpane bin serve as di Chief Financial Officer for di South African Police Services.
Di president tok say she get reputation in professionalism and integrity and e dey confident say she get di qualities and resources to provide effective leadership to di South African Police Service.
Ramaphosa task di leadership within di police service to address di weakness in procurement system for goods and services for di police service.
Di president tok say procurement don become source of corruption of office and instability within di police service.
"Di minister of police go support di work wey di South African police leadership, must now undertake to insinuate procurement processes from any form of manipulation," Ramaphosa tok.
"Di acting national police commissioner dey expected to sustain di momentum of di national fight against crime and corruption."
Wetin be di allegations against Fannie Masemola?

Wia dis foto come from, Frennie Shivambu/Gallo Images via Getty Images
Fannie Masemola, 62, dey face four-count charges ova one controversial $21m (£15.5m) health contract, wey dey under investigation.
Dem don charge am wit violation of South Africa Public Finance Management Act wey dey govern how dem take dey spend taxpayers money.
Masemola tell tori pipo afta di hearing on Tuesday say e deny di charges against am.
'I know say I no dey guilty, I no do any wrong, but di [law] go take im course,' e tok.
E neva plead to di charges against am, but e fit face up to five years for prison, if dem find am found guilty.
Masemola na di third South Africa police chief wey don face criminal investigation while e still dey for office.
Who be Puleng Dimpane?
Lieutenant General Puleng Dimpane bin serve as di Chief Financial Officer for SAPS.
She don dey wit SAPS for almost twenty years afta she join for 2007 as internal auditor.
She get Bachelor Degree in Commerce as well as Honours Degree for Business Administration.
Dem appoint her as CFO for 2018 - afta dis dem promote her to di rank of Lieutenant General.
For 2013, dem appoint her as deputy provincial head wia she serve for six years.










