Perpetrators of violence against foreign nationals go face arrests and charges - Ramaphosa

Wia dis foto come from, RODGER BOSCH / AFP via Getty Images
President Cyril Ramaphosa say citizens wey dey harass foreign nationals for di kontri go face di full wrath of di law.
Di South Africa leader say di police don begin dey process di reports and evidence wey dem gada about di violence against foreign nationals.
E add say security agencies don make arrest and dem go prosecute dose wey dem find say violate di law.
"Di issue of di instigators of dis violent actions wey some pipo don take against pipo from oda kontris na matter wey dey under process. Di police don inform us, and all security apparatus don inform us say dem dey follow up on it," Ramaphosa say.
Di South African leader give dis informate as e dey respond to one question di Economic Freedom Fighters leader Julius Malema for Parliament on Tuesday, on top violence against African foreign nationals for South Africa.
Malema bin allege say perpetrators for some instances don commit violence for di presence of police officers without being arrested, and e create di impression say di attacks na state-sanctioned.
E question why authorities neva arrest and prosecute dos wey dey responsible.
For im response, di president say dem dey attend to di mata.
Different foreign nationals don face series of attacks for South Africa sake of lack of papers and dem accuse some of taking dia jobs.
Trending videos show as South African citizens dey pursue some foreigners comot from shops, wit claim say dem dey live for di kontri illegally.
One big protest don happun and some groups still dey plan anoda September 30 deadline protest for illegal migrants.
Nigeria and Ghana dey among kontris wey don evacuate dia citizens comot from South Africa sake of di attacks while oda kontris don also withdraw dia citizens.
However, dis no be di first time wey South Africa president go tok say dem go punish pipo wey dey illegally attack foreigners.
But dis time around, for one parliament session, Ramaphosa tok tough on wetin govment dey do concerning violence against foreign nationals.
'We go deal wit dose wey violate di law' - Ramaphosa reply Malema
Ramaphosa say dem don begin process to prosecuter offenders and evrione wey dey violate di law.
Di president e dey concerned about wetin some South Africans dey do foreigners particularly dose wey be Africans.
"A number of oda pipo dey arrested, and of course, dose odas wey we don see to lead dis processes na also pipo of interest, of direct interest to di police, and dat process go dey followed up," President Ramaphosa say.
"We dey obviously concerned about di actions against any Africans for our kontri, and we don make am clear say dose wey violate di law, dose wey disobey various precepts of our laws, go dey dealt wit," e say.
According to Ramaphosa, e say di police go pursue cases wey involve violence and even dose wey torchlight incidents leading to deaths and injuries to victims.
Di president say for case wia di incident result in deaths or injury, dem go follow am up and ensure say dose wey do am go face di law.
For previous times, Ramaphosa don reject claims say South Africa dey xenophobic but dem dey put measures in place to address dia immigration wahala.
South African President Ramaphosa bin address di nation for June 2026, wia e torchlight say di kontri no go gree for illegal migration afta series of protests against foreign nationals.
E also tok about govment approach to address illegal migration and di recent rise in protests against foreign nationals for South Africa.
Since dat time, di kontri don dey put some measures in place, including blocking certain IDs for pipo to come claim dia identity.
South Africa for dia Trusted Employer Scheme (TES) tell companies, businesses and oda employers for di kontri to consider mostly dia citizens and permanent wen dem dey employ.
Also, in recent times, South Africa dey witness increase in arrest of undocumented foreign nationals.
Ramaphosa tell di parliament on Tuesday 25 August, 2026 say dem dey set up reforms to strenghten border management, tackle corruption within di immigration system and improve legal migration pathways.
Di President say "South Africa don dey engage wit oda African kontris on migration through di African Union (AU) and di Southern African Development Community (SADC).
President Ramaphosa say dem go approach di issue and make sure say migration dey managed through lawful and better means.










